level
Naija
Etymology
From: English level
Pronunciation
- lɛ́vù
Noun
- Person way or as person or someting take dey dey.
- Pidgin get level. — (ABJ_INF_05_On-Pidgin_M__69, Pidgin has a positive status.)
- But di level of security for ground still get as e be. — (bbc__22231, The security situation is still precarious.)
- E senior me for age, but I senior am for level. — (LAG_11_Adeniyi-Lifestory_MG__126, She may be older but I am better off.)
- Na anyting, person, or condition wey person dey talk about.
- Guy, you go bring di level abi you no bring am, my throat don dry. — (NSC_Odirin_2020, Will you come with the drink, I am parched.)
- Arrange level make we fit use dey abeg, sapa full ground. — (NSC_2021, Fix something for us, things are somewhat hard.)
Related forms
Antonyms
Translations
- English: status, something
Verb
Make someting or somewhere reduce.
- De go level ground. — (NST_cleaned__6509, The ground will be levelled.)
- How una take level dat big bowl of eba sharp sharp? — (NSC_Odirin__2020, How did you guys finish the mound of garri meal?)
Translations
English: raze