light

Naija

Etymology

From: English light

Pronunciation

  • laɪ̑t

Play Play

Noun

  1. Wetin de dey bright wey people dey take dey see or to do someting.
    • I no fit see anyting for dis place, abeg on light for me.  — (I can't see anything in this place please, switch on the power.)
  2. Electric power wey NEPA dey bring.
    • Dem don bring light finally.  — (The power has finally been restored.)

Translations

  • English: illumination, light

Adjective

  1. Sey someting no get weight and e no heavy.
    • Madam dis dis bag light. You sure say someting dey inside?  — (Madam this bag is light are you sure there's something inside?)
  2. Sey person skin no black and e no too yellow.
    • Who be dat light skin girl wey dey come here?  — (Who is the light skin girl that usually comes here?)
  3. Drink wey no too dey enter eye like dat.
    • As you sey make dem give you wetin light, you mean sey make dem give you soft or make dem give you di one wey no too strong?  — (When you say you want something light, do you mean you should be given a soda or something with little alcohol?)
  4. Food wey no heavy, wey no go fit full person belle.
    • Dis ting wey dey your food no be someting light o. Four fufu light? Four fufu and six meat light? If want chop someting light e no suppose pass meatpie or ten ten naira buns naw! You be tief! You suppose dey carry gun.  — (This food is not light! Are four morsels light? Are four morsles and six pieces of meat light? If you want to eat something light it shouldn’t be more than meatpie or buns sold for 10 naira! You are a thief. You should be armed.)

Synonyms

soft

Translations

  • English: light

Verb

  1. Make dem slap person for face.
    • Stop to dey misbehave before I light you now.  — (Stop misbehaving before I give you a slap.)
  2. Make dem on fire for someting.
    • Go light di firewood I wan start to dey cook.  — (Go light the firewood. I want to start cooking.)

Synonyms

slap

Translations

English: light, slap