pass
Naija
Etymology
From: English pass
Pronunciation
- pâs
Verb
- Make person or someting waka follow one side.
- Oga waka pass quick. — (LAG_22_I-Senior-You_DG__175, Please move along quickly.)
- Abeg waka pass. — (LAG_22_I-Senior-You_DG__171, Please pass through.)
- Make person carry someting give anoder person.
- Bros abeg help me pass dat salt come dis side. — (Bro please, hand over the salt to me.)
- Di ting be sey JayJay sabi pass ball and e sabi dribble, and e still dey score. — (The thing is that JayJay can pass the ball, dribble and he also scores.)
- Make time no dey for someting again.
- All the years wey pass. — (jw__1242, All the years that slipped away.)
- As you no gree finish quick, I no dey go again. Time don pass already. — (Since you did not get ready on time, I am no longer going. The time is already late.)
- Make person do well for exam.
- E no go fail dis year, because e pass all im exam. — (He won't fail this years, because he passed all his examinations.)
- Make someting plenty.
- Di people wey I see wey ekelebe carry pass' twenty five — (The people I saw who the police arrested were more than twenty five.)
- Di rice wey I buy today pass yesterday own. — (The rice I bought today is of a larger quantity than the one I bought yesterday.)
- Who dey make moni pass for Nollywood? — (bbc__100171, Who makes more money in Nollywood?)
Synonyms
Antonyms
Translations
- English: Pass
Noun
- Wetin de dey call wetin dey happen wey be sey person carry someting give anoder person. (De dey use am for sports)
- Na di same Messi dey involve for di next goal, after Dembele collect pass from di striker hammer in di second goal. — (bbc__70511, It was this same Messi that was involved in the next goal, after Dembele hijacked the ball and passed from the striker to scored the second goal.)
- Wetin person dey collect wey be sey e go let am enter some kind place.
- You tink sey na to just wear suit dey speak grammar? If you no get pass, de security go too beat beat you. — (You think all you'll have to do is just wear a suit and speak English eloquently? If you don't have a pass, you'll be beaten mercilessly.)
Translation
- English: pass, permit