pass
Naija
Etymology
From: English pass
Pronunciation
- pâs
Verb
- Make person transfer someting give another person.
- Na di same Messi dey involve for di next goal, after Dembele collect pass from di striker hammer in di second goal. — (bbc__70511, It was this same Messi that was involved in the next goal, after Dembele hijacked the ball and passed from the striker to scored the second goal.)
- Bros abeg help me pass dat salt come dis side. — (NSC_2021, Bro please, hand over the salt to me.)
- Make someting or person follow one place waka.
- Make person or someting waka tru one place
- Oga waka pass quick . — (LAG_22_I-Senior-You_DG__175, Please move along quickly away.)
- Abeg waka pass. — (LAG_22_I-Senior-You_DG__171, please pass through.)
- Make time no dey for someting again.
- All the years wey pass. — (jw__1242, All the years that slipped away.)
- As you no gree finish quick, I no dey go again. Time don pass already. — (NSC_2021, Since you did not get ready on time, I am no longer going. The time is already late.)
- Make someting end or finish.
- E go come to pass. — (JOS_23_Wedding_DG__29, It will come to pass.)
- Make person do well for exam.
- E no go fail dis year, because e pass' all im exam. — (NSC_2021, He won't fail this years, because he passed all his examinations.)
- Make someting plenty.
- Pass ten. — (WAZK_05_Reincarnation_DG__155, More than ten.)
- Di rice wey I buy today pass yesterday own. — (NSC_2021, The rice I bought today is of a larger quantity than the one I bought yesterday.)
- Who dey make moni pass for Nollywood? — (bbc__100171, Who makes more money in Nollywood?)
Synonyms
Antonyms
Translations
- English: Pass
Noun
- Name of someting wey person dey use enter somewhere.
- If I no see my pass, I no dey show for dat party. — (NSC_2021, If I do not secure a pass, I won't be attending the party.)
Translations
- English: pass, permit