pieces

Naija

Etymology

From: English pieces

Pronunciation

  • pɪ́sɪ̀s

Play Play

Noun

  1. Someting wey de cut small small.
    • Dis meat small o, how many pieces you see buy?  — (This meat is rather small, how many pieces did you buy?)
  2. Cloth wey remain when e be sey tailor don cut wetin e want use take sew cloth.
    • Shey you know sey you fit collect pieces for tailor shop use am take do one kind ghenghen pattern?  — (You know that you collect pieces of cloth from the tailor's shop and make a really nice pattern from them, right? )
    • Tailor shop wey no get pieces shey di tailor sabi im work at all at all?  — (If you don't find pieces of cloth in a tailor's shop, does the tailor even know their job at all?)
  3. Small small wood wey dey when carpenter don cut di one wey e want use take do someting.
    • No dey pack pieces dey comot for carpenter shop like dat. E fit get wetin im want use am do.  — (Don't just throw away pieces of wood in a carpenter's shop, they could come in handy for something.)
    • When we small, we dey go find pieces for carpenter shop, take am dey do small small car.  — (When we were kids, we go to pick pieces of wood from the carpenter's shop to make small cars.)

Translation

  • English: bits, pieces

Verb

  1. Make person cut cut someting smallsmall.
    • No cook dat cow leg like dat o, pieces am.  — (Don't cook the beef whole, chop it into pieces.)
    • Different diiferent style dey how people dey like cook deir yam. Some people dey cut am like bread, de go slice am, round round. Some people dey pieces am.  — (People like to cook their yam differently. Some like to slice it, while others like to cut it into chunks.)
  2. Make person use mouth take yab yab person.
    • Some people mouth sharp, die! De go use mouth pieces you.  — (some people really have a sharp mouth, they can make very derogatory remarks and hurt you.)
    • Dose people wey dey sell market no go follow dem drag, de go use mouth pieces you.  — (Don't exchange words with people at the market, they'll hurt you with their words.)
  3. Make person do someting wellwell.
    • Di way dat guy take pieces di course eh, even lecturer bow.  — (The young man performed so well, even the lecturer was impressed.)
    • Una still dey ask how dat babe take run dat debate; e pieces am.  — (You are still asking how the lady performed at the debate? She did a great job.)
  4. Make dem shoot person.
    • If you see how police take pieces people wey go tief for di bank eh, you go vomit.  — (If you see how the police riddled the bank robbers with bullets, you'll throw up.)
    • No go dey claim odeshi o, de go too pieces you o.  — (Don't go about claiming to be invulnerable to bullets.)


Translation

  • English: dice, chop, insult, shoot, perform excellently