pieces

Revision as of 21:13, 2 December 2021 by Emeka (talk | contribs) (Created page with "==Naija== ===Etymology=== From: English ''pieces'' ===Pronunciation=== pɪ́sɪ̀s <sm2>Pcm-ng-pieces.f.ogg</sm2> <sm2>Pcm-ng-pieces.m.ogg</sm2> ===Noun=== # Someting wey de...")
(diff) ← Older revision | Latest revision (diff) | Newer revision → (diff)

Naija

Etymology

From: English pieces

Pronunciation

pɪ́sɪ̀s Play Play

Noun

  1. Someting wey de cut small small
    • Dis meat small o, how many pieces you see buy?  — (NSC_2021, This meat is rather small, how many pieces did you buy?)
  2. Cloth wey remain when e be sey tailor don cut wetin e want use take sew cloth
    • Shey you know sey you fit collect pieces for tailor shop use am take do one kind ghenghen pattern?  — (NSC_2021, You know that you collect pieces of cloth from the tailor's shop and make a really nice pattern from them, right? )
    • Tailor shop wey no get pieces shey di tailor sabi im work at all at all?  — (NSC_2021, If you don't find pieces of cloth in a tailor's shop, does the tailor even know their job at all?)
  3. Small small wood wey dey when carpenter don cut di one wey e want use take do someting
    • No dey pack pieces dey comot for carpenter shop like dat. E fit get wetin im want use am do.  — (NSC_2021, Don't just throw away pieces of wood in a carpenter's shop, they could come in handy for something.)
    • When we small, we dey go find pieces for carpenter shop, take am dey do small small car.  — (NSC_2021, When we were kids, we go to pick pieces of wood from the carpenter's shop to make small cars.)

Translation

  • English: bits, pieces

Verb

  1. Make person cut cut someting smallsmall.
    • No cook dat cow leg like dat o, pieces am.  — (NSC_2021, Don't cook the beef whole, chop it into pieces.)
    • Different diiferent style dey how people dey like cook deir yam. Some people dey cut am like bread, de go slice am, round round. Some people dey pieces am.  — (NSC_2021, People like to cook their yam differently. Some like to slice it, while others like to cut it into chunks.)
  2. Make person use mouth take yab yab person.
  • Some people mouth sharp, die! De go use mouth pieces you.  — (NSC_2021, some people really have a sharp mouth, they can make very derogatory remarks and hurt you.)
  • Dose people wey dey sell market no go follow dem drag, de go use mouth pieces you.  — (NSC_2021, Don't exchange words with people at the market, they'll hurt you with their words.)
  1. Make person do someting wellwell
  2. Make dem shoot person.