play
Naija
Alternative forms
play
Etymology
From: English play
Pronunciation
- plẽ
Frequency
- Frequency in NSC treebank: 68
- Frequency rank in NSC treebank: 191
- Frequency in raw corpus: 2339
- Frequency rank in raw corpus: 172
Definition
As person take dey catch fun
Noun
- As person dey move bodi for game.
- But dem go need play as independent sport people dem. — (bbc__22028, But they will need to play as independent sports persons.)
- Sometime only me go just dey like dis dey play wit my leg. — (KAD_07_Receptionists_DG__171, Sometimes, I alone will just be there playing with my leg.)
- Some of dem no dey take this work wey we give dem play. — (jw__980, Some of them are serious with this work we gave them.)
- Drama wey person write.
- Di play don land for pidgin. — (bbc__101844, The play is now in pidgin.)
- Club wey person dey.
- Di 42-year-old play for Real Madrid, Inter Milan, AC Milan and Barcelona for im 18-year football career. — (bbc__30536, The 42-year old played with Real Madrid, Inter Milan, AC Milan and Barcelona in the 18-year period of his football career.)
- Mahrez bin dey hope say im go dey follow Manchester City play. — (bbc__64815, Mahrez was hoping that he would go and play in Manchester City.)
- Where game dey take place.
- Racism dey come in different forms, some na through social media , some for field of play, even players dey racially abuse their opponents, some na from wetin dem write or too and so on. — (brila__1330, Racism comes in different forms, some on social media, some on the field of play, even players racially abuse their opponents, some from what they write and so on.)
- no pure
- This kind ' na serious matter, because e fit lead to rape. — (jw__36959, This manner of behaviour is a serious matter because it can lead to rape.)
- INEC oga say e no go good if foul play enter the election for Edo and Ondo. — (NSC_Odirin 2020, The INEC boss said that it would be unfair if malpractice is recorded at the Edo and Ondo elections.)
Related forms
Antonyms
work
Translations
- English: activity, game
Verb
- Make person dey move bodi take catch fun.
- Na so we play tire when school close today. — (NSC__Odirin 2020, That is how we played to the point of exhaustion after school closed today.)
- De go go play for sun, use sand rub head, rub face, take am bath. — (NST_cleaned_21878, They will go and play in the sun, rub their heads with sand, rub their faces, bathe with it.)
- Make person take wayo collect someting.
- You just dey chop mouth sey you too sharp sake of say correct yahoo boy never play you before. — (NSC_Odirin 2020, You are there boasting that you are not gullible because a seasoned fraudster has not played you before.)
- Make person start film or music.
- Abeg play your marriage video make I see as you take kiss your bride. — (NSC__Odirin 2020, Please play me the recording of your marriage so I will see how you kissed your bride.)
- Di Dj no gree play Davido and Wizkid song for di party. — (NSC_Odirin 2020,The Dj refused to play Davido's and Wizkid's songs at the party.)
- Papa Emeka, you know sey children like play pass food so no dey blame am sey e no quick return from school. — (NSC_Odirin 2020, Papa Emeka, you know that children prefer playing to eating so do not scold him for coming back late from school.)
- Make person perform.
- Super Eagles no fit even draw with Algeria for friendly because di players no play with church mind make injury no bench dem for di season wey just start. — (NSC_Odirin 2020, The Super Eagles could not manage a draw with Algeria in the friendly match because the players did not give their best for fear of getting sidelined due to injury this new season.)
- Make Man U. fans ready sey na Europa League sure for dem if di players no wan play well this season. — (NSC_Odirin 2020, Man U. fans should prepare their minds that the players will definitely end up in the Europa League if they do not perform well this season.)
- You sabi di people wey dey play? — (KAD_03_Why-Men-Watch-Football_MG__15, Do you know those who are playing?)
- Sey person see someting as important
- E no dey take im name dey play. — (jw__9057, He/She does not joke with his reputation.)
- Na play una dey play here? — (NST_cleaned__31277, Are you guys joking here?)
- We know sey to train pikin no easy, so we no use am play at all. — (jw__38986, We know that raising a child is not easy, so we do not joke with it at all.)
- Sey someting dey sup
- You know wetin de play… — (ENU_Football_Fans__Discussion_DG, Do you not know what is happening?)
- Make person dey gamble.
- All dose ehn Naijabet wey dem dey say de dey play. — (BEN_17_Cctv-Jamb-And-Elections_DG__103, All those ehn Naijabet which they are saying that they are playing.)
- Sey person dey make song comot.
- Apart from that one, e arrange Levite wey go dey sing and play music. — (jw__25331, Besides that, he arranged Levites who will sing and play music.)
- {ux|dv|I dey always play music make my brain cool down when stress want kill me.|NSC_Odirin 2020, I usually play music to calm my head when I am stressed out.)}}
- Make person deceive person
- Onto sey e sabi play wayo collect people money na so de begin call am "fast guy no be thief". — (NSC__Odirin 2020, Because he knows how to play a fast one on people that is how they nicknamed him "a fast guy is not a thief". )
- Make person join for game.
- But, na 11 against 11 go play on Sunday. — (bbc__38630, But it is 11 against 11 who will play on Sunday.)
- And to dey always play match, even if na International friendly, because FIFA dey reduce point for teams wey e don tay since dem last play match. — (bbc__11400, And to always play matches, even they are friendlies, because FIFA reduces points for teams that allow long intervals in between matches.)
- Sey person dey do someting for any place or anybodi
- Na Nigeria youth dey play better role for di country pass people wey dey power. — (NSC__Odirin 2020, It is the Nigerian youths who are doing positive things in the country than the ruling class.)
- Sey person dey romance person
- Di way di babe hair scatter when e come out for oga office e clear sey dem don play wella. — (NSC_Odirin 2020, From the way the lady's hair was dishevlled when she came out of the boss' office it is clear that they have been romancing.)
Related forms
Synonyms
- perform, knack,
Antonyms
- work,
Translations
- English: to play, to trick, to flirt, to perform,