rough play

Naija

Alternative Form

Etymology

  • From English: rough and play

Pronunciation

rɔ́f plê Play Play

Noun

  1. Someting wey be sey person do wey fit make person vex.
    • You don first tell me sey na today you go pay, now wey I don come, you dey tell me sey noting dey. Which kind yeye rough play be dat? Abi when you dey beg make I borrow you, you loss your sense?  — (You had already said that you were going to pay today; now I'm here and you are saying you don't have any money. What stupid behaviour is that? When you were pleading with me to lend you some money were you out of your mind?)
    • You no see who want follow kwanta, na soldier you go follow dey play rough play. Na only pele I get to tell you sha.  — (You didn't see who else to quarrel with, but you chose to take up issues with a soldier. I can only empathize with you.)
  2. Make man and woman dey like like deirsef when e be sey de no suppose dey do am.
    • Una don start rough play, as una no tell us when una start, no tell us when una finish.  — (You both have started frolicking around, since you didn't tell us when you started, please spare us the details when you both are done.)
    • Na wa, you dey follow landlord pikin dey play rough play. See you see under bridge.  — (You are flirting with the landlord's daughter. You'll soon find yourself under the bridge.)

Related forms

play

Translation

  • English: stupid behaviour, flirting