run

Naija

Etymology

From: English run

Pronunciation

  • rôn

Play Play

Verb

Intransitive

  1. Make person carry leg move with speed from one place go reach another place
    • Run! Popo don show with gun, dem go shoot us if we no take off sharp sharp.  — (NSC__Abonyi_2020, Run! The police have arrived with guns; they will shoot us if we do not run at once.)
    • Tori be say some of di officers fire shots and pipo run for dia life.  — (bbc__95319, The story is that some of the officers fired shots and people ran for dear lives)
    Di referees bin show Okagbare-Ighotegunor red card afta she begin run before dem blow whistle.  — (bbc__37808, __no translation__)
    • As e enter, na so all of us run.  — (ABJ_INF_09b_Old-Time-School_M__57, As soon as she entered, we all ran away.)
  2. Sey person no gree do someting wey no good
    • Wetin go help us run from sex wey no clean for God eye?  — (jw__42134, What will help us avoid unclean sex in God's eye?)
    • E good make students wey de do WAEC run from any kind bullet.  — (NSC__Abonyi_2020, It is good that students sitting for WAEC avoid all forms of examination malpractice.)
  3. Make person escape comot from somewhere or someting
    • This kain behaviour don show say she be person wen fit run.  — (bbc__6311, This kind of behaviour has revealed that she is one who is likely to abscond.)
    • Joseph and Mary carry their pikin run go Egypt that night, dem no waste time.  — (jw__21516, Joseph and Mary escaped with their child to Egypt that night, they didn't tarry.)

Transitive

  1. Make person dey control somewhere or someting
    • Government tire as de no know who dey run di protest for everywhere for di country.  — (NSC__Abonyi_2020, The government is confused as to who is in charge of the protest going on in different parts of the country.)
    • Nowadays e be like say na woman come dey run house sake of sey many don begin work office work.  — (NSC__Abonyi_2020, These days it looks as if the woman is the one who runs the home as many of them have started entering the corporate workplace.)
    • For Nigeria sports, na di men dem dey run things.  — (bbc__50513, In Nigeria sports it is the men who are in charge.)
  2. Sey person carry someting from place go another place
    • I have package to run.  — (JOS_40_Travelling-On-Nigerian-Roads_DG__82, I have a package to deliver.)
  1. Make person charter/use/someting
  1. Make person dey use mouth talk anyhow
    You still dey make your mouth dey run like sey…  — (NST_cleaned__14891, You are still running your mouth)

Related forms

Translations

  • English: run