run

Naija

Etymology

From English: run

Pronunciation

  • rɔ̂n

Play Play

Verb

  1. Make person carry leg move with speed from one place go reach another place.
    • Tori be say some of di officers fire shots and pipo run for dia life.  — (bbc__95319, The story is that some of the officers fired shots and people ran for dear lives.)
    • As e enter, na so all of us run.  — (ABJ_INF_09b_Old-Time-School_M__57, As soon as she entered, we all ran away.)
  2. Sey person no gree do someting wey no good.
    • Wetin go help us run from sex wey no clean for God eye?  — (jw__42134, What will help us avoid unclean sex in God's eye?)
    • E good make students wey de do WAEC run from any kind bullet.  — (It is good that students sitting for WAEC avoid all forms of examination malpractice.)
  3. Make person escape comot from somewhere or someting.
    • Dis kain behaviour don show say she be person who fit run.  — (bbc__6311, This kind of behaviour has revealed that she is one who is likely to abscond.)
    • Joseph and Mary carry their pikin run go Egypt that night, dem no waste time.  — (jw__21516, Joseph and Mary escaped with their child to Egypt that night, they didn't tarry.)
  4. Make someting dey move fast fast.
    • Dis your car dey run o.  — (Your car is fast.)
    • Di ting wey dey make me no dey like enter car wey you dey drive na sey you too dey run. Small small o, e no get who dey pursue you. Na go we dey go di party, no be we dey do di wedding.  — (The reason why I don't like to enter a car you are driving is that you speed a lot. Take it easy. No one is chasing you. We are guests at the party, we are not the couple getting married.)
    • Chop your December salary small small o. January no dey like run o.  — (Spend your December salary in small bits. January likes to take its time.)
  5. Make person do someting.
    • Dat matter, we run am. We close eye run am because e con be like sey we no go fit finish.  — (That matter, we executed it. We put in all we could to ensure that we got it done because it seemed like we were not going to be able to finish.)
    • Dat advert wey I see, na una company run am?  — (That advert I saw, was it your company that did it?)
  6. Make person be oga for place.
    • Shebi na Ochuko dey run dat viewing centre?  — (Isn't Ochuko in charge of the viewing centre?)
    • Di guy never even really tay for di place de con say make e dey run am.  — (The man had barely been there for a while before he was asked to manage the place.)

Translations

  • English: run, speed, manage,