run
Naija
Etymology
From: English run
Pronunciation
- rôn
Verb Intransitive
- Make person carry leg move with speed from one place go reach another place.
- Run! Popo don show with gun, dem go shoot us if we no take off sharp sharp. — (NSC__Abonyi_2020, Run! The police have arrived with guns; they will shoot us if we do not run at once.)
- Tori be say some of di officers fire shots and pipo run for dia life. — (bbc__95319, The story is that some of the officers fired shots and people ran for dear lives)
- Di referees bin show Okagbare-Ighotegunor red card afta she begin run before dem blow whistle. — (bbc__37808, __no translation__)
- As e enter, na so all of us run. — (ABJ_INF_09b_Old-Time-School_M__57, As soon as she entered, we all ran away.)
- Sey person no gree do someting wey no good.
- Wetin go help us run from sex wey no clean for God eye? — (jw__42134, What will help us avoid unclean sex in God's eye?)
- E good make students wey de do WAEC run from any kind bullet. — (NSC__Abonyi_2020, It is good that students sitting for WAEC avoid all forms of examination malpractice.)
- Make person escape comot from somewhere or someting.
- This kain behaviour don show say she be person wen fit run. — (bbc__6311, This kind of behaviour has revealed that she is one who is likely to abscond.)
- Joseph and Mary carry their pikin run go Egypt that night, dem no waste time. — (jw__21516, Joseph and Mary escaped with their child to Egypt that night, they didn't tarry.)
Transitive
Make person dey control somewhere or someting.
- Government tire as de no know who dey run di protest for everywhere for di country. — (NSC__Abonyi_2020, The government is confused as to who is in charge of the protest going on in different parts of the country.)
- For Nigeria sports, na di men dem dey run things. — (bbc__50513, In Nigeria sports it is the men who are in charge.)
Translations
- English: run