runs

Naija

Etymology

From English: run

Pronunciation

  • rɔ̂ns

Play Play

Noun

  1. Wetin person dey do wey dey bring money for am.
    • Ochuko say im dey come gidi because e get some runs for Lekki.  — (Ochuko said he'll come to Lagos beacause he has a thing or two he wants to do in Lekki.)
    • No be bad ting if you clear your guy sey see di runs wey e go fit do wey go let am dey alright.  — (It's not bad if you tell your friend things he can do to make ends meet.)
  2. Di ting wey person dey do wey be illegal.
    • Which kind runs di guy do wey police take gbab am?  — (What illegal act was he arrested for?)
    • Any teacher wey dey help students do exam runs, if de catch am, na panti e dey go straight!  —  ( Any teacher caught aiding examination malpractice, if caught, will go straight to jail.)
  3. Wetin person dey do wey e no suppose dey do.
    • Lanre get sharp runs for dat side.  —  (Lanre has a very quick thing to do there.)
  4. Make person dey follow person dey collect money.
    • Runs no be wetin person go pray make im pikin dey do.  — (No one will pray for their child to be an escort.)
    • People wey dey do runs dey get mind.  — (Escorts are very bold.)

Translation

English: efforts. illegality, escort

Verb

  • Make person do illegal take get someting.
  • Im don runs im posting go Calabar.  — (He has influenced his posting to Calabar.)
  • Na after time don pass im still dey ask me if we go still runs dat level.  — (After the time has elapsed, he was still asking me if we could arrange that thing.)

Related terms

runs girl

Translation

English: manipulate