runs
Naija
Etymology
From English: run
Pronunciation
- rɔ̂ns
Noun
- Wetin person dey do wey dey bring money for am.
- Ochuko say im dey come gidi because e get some runs for Lekki. — (Ochuko said he'll come to Lagos beacause he has a thing or two he wants to do in Lekki.)
- No be bad ting if you clear your guy sey see di runs wey e go fit do wey go let am dey alright. — (It's not bad if you tell your friend things he can do to make ends meet.)
- Di ting wey person dey do wey be illegal.
- Which kind runs di guy do wey police take gbab am? — (What illegal act was he arrested for?)
- Any teacher wey dey help students do exam runs, if de catch am, na panti e dey go straight! — ( Any teacher caught aiding examination malpractice, if caught, will go straight to jail.)
- Wetin person dey do wey e no suppose dey do.
- Lanre get sharp runs for dat side. — (Lanre has a very quick thing to do there.)
- Make person dey follow person dey collect money.
- Runs no be wetin person go pray make im pikin dey do. — (No one will pray for their child to be an escort.)
- People wey dey do runs dey get mind. — (Escorts are very bold.)
Translation
English: efforts. illegality, escort
Verb
- Make person do illegal take get someting.
- Im don runs im posting go Calabar. — (He has influenced his posting to Calabar.)
- Na after time don pass im still dey ask me if we go still runs dat level. — (After the time has elapsed, he was still asking me if we could arrange that thing.)
Related terms
Translation
English: manipulate