security

Naija

Etymology

From: English security

Pronunciation

sɛ̀kúrítì


Noun

  1. Person wey be sey im work na to make sure sey noting no bad ting do person.
    You go carry security follow body, normal.  — (You will take a security personnel along, as you should )
    You don dey do security? Go make dem cook you o. No be by big chest and ogogoro eye.  — (You are now a guard? Go and get fortified. It’s not just about having a broad chest and gin stained eyes.)
  2. As e dey be wey be sey people go dey and people go dey do deir ting dey go and person no go steal from dem or kill dem, or do dem physical bad ting.
    No be everywhere for di area get better security naw. But you sha know sey na who get money thief dey go im house. So una no get wahala.  — (Not everywhere around the area is safe. But, anyway, you know that thieves only go to staeal from wealthy people. So. You don’t have anything to worry about.)

Translation

English: Security