teddy

Naija

Etymology

From: English teddy

Pronunciation

  • tɛ̀dí

Play Play

Noun

  1. One kind of baby wey dey very very soft wey dey get foam inside wey children dey play with.
    • I wan buy teddy for my pikin today.  — (I want to buy a teddy bear for my daughter.)
    • Dis teddy wey you get too big o!  — ( This teddy bear of yours is really big.)
  2. Hair wey dey grow for di side of di face wey dey start from di hair wey dey for head wey go con grow reach hair near di ear.
    • Dis your barber sabi o, see as your teddy make sense.  —  (Your barber is really good, your sideburns look very good.)
    • No go rub engine oil for your face o because you dey find teddy. If e no dey e no dey.  —  (Don’t go about putting engine oil on your face because you are looking for sideburns. If it isn’t there, it isn’t there.)

Synonyms

Translations

  • English: teddy bear, sideburns

Adjective=

  • Person wey be sey im mama and im papa get money, e dey dress wellwell, and e dey sabi follow people talk and play well well.
  • Find house around dat Government house side. Dat side na for teddy people. If you use because sey dat garage side cheap, you go see wetin pass your eye.  —  (Look for an apartment around the government house. That’s where privileged people stay. If you decide to go to the motor park area because it’s cheap, you’ll see more than what you can handle.)

=Synonym

ajebo, ajebutter

English

Privileged person