testing

Revision as of 17:40, 16 October 2020 by 154.66.42.138 (talk) (→‎Noun)

Naija

Etymology

From: English testing

Pronunciation

  • tɛ́stìŋ

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 0
  • Frequency rank in NSC treebank: inf
  • Frequency in raw corpus: 39
  • Frequency rank in raw corpus: 3688

Usage

Dem dey use am pass for matter wey be health matter.

Definition

Condition where person dey check for yamayam or diziz wey fit dey body.

Noun

  1. Wetin de dey use check for someting.
    • Authorities don take blood samples from di patient for testing and dey expect di test result within di next 24 hours.  — (bbc__18024,The authorities have taken blood samples from the patient for testing and they expect the test results within the next 24 hours.)
    • Zimbabwe: Cholera don kill four people Zimbabwe: 'Wait and Get' HIV testing machine  — (bbc__102194, Zimbabwe: Cholera has killed four people Zimbabwe: 'Wait and get testing machine'.)
    • Dr Oscar say dem don get some lab equipment for testing, wey dey very necessary to make di breast milk bank work, but support from people dey slow maybe because of recession.  — (bbc__43431, Dr Oscar said they have gotten some lab equipment for testing, which will make the breast milk bank function. however, support from people is not encouraging. )
    • For di six months wey remain, government go put am for testing.  — Egbokhare no translation
    • Di health minister say HIV no be death sentence and dis kain testing kit don common well well and e good  — (bbc__35148, __no translation__)
    • As court think am well, di testing go dey for terms and condition sey wheda di person go fit maintain di pikin, send am go school and care for am.  — (hildrights__10, __no translation__)
    • According to Congo health ministry informate wey dem release late on Saturday, na four cases of Ebola wey dem don confam through testing for Mbandaka Wangata area and anoda two suspected cases.  — (bbc__11355, __no translation__)
    • Research wey come from di Indian Council of Medical Research say because people no too know about cancer and because dem no dey go for testing, only 12.5% of patients dey come for treatment during di early stages of di disease.  — (bbc__85025, __no translation__)
    • Point of Care mean say e go dey possible now to do immediate testing and treatment anywhere, instead of di way e be before where person go need go one lab, for where results fit tay before e comot.  — (bbc__82211, __no translation__)
    • SPL Di new testing machine for HIV mean say e go dey possible now to do immediate testing and treatment anywhere Zimbabwe Ministry of Health and Child Care, with support from The Global Fund, don buy 100 HIV point of care machines for $5m as part of plan to make am easy for people wey dey rural area to fit test.  — (bbc__86342, __no translation__)
    • Afta dat, we go dey do periodic market testing, she explain.  — (bbc__152, __no translation__)

Translations

  • English: testing

Verb

  1. Make dem dey try to see how someting dey work.
    • Wetin dem dey do now na testing before dem go begin full production and exportation for around 2024.  — (bbc__99258, __no translation__)
  2. Make dem check for yamayama and diziz wey dey body.
    • Twitter/ Nigeria goment don approve one new testing kit wey go allow anybody to check by imself whether e get HIV.  — (bbc__96262, __no translation__)
    • SPL Di new testing machine for HIV mean say e go dey possible now to do immediate testing and treatment anywhere Zimbabwe Ministry of Health and Child Care, with support from The Global Fund, don buy 100 HIV point of care machines for $5m as part of plan to make am easy for people wey dey rural area to fit test.  — (bbc__86342, __no translation__)
    • Di state-of-the-art machines wey fit do viral load testing and Early Infant Diagnosis for HIV, go help di country meet dia goal to end AIDS for year 2020.  — (bbc__38522, __no translation__)

Translations

  • English: testing