yab
Naija
Etymology
From: English jab
Pronunciation
- yâb
verb
- make dem make fun of person
- I no like de new school, de teachers too dey yab person wey enter de school newly. — NSC_Agnes_2020( I dislike the new school because teachers poke jokes at new students mercilessly.)
- De boys yab de new girl so tey she come learn to freestyle wit dem, . — NSC_Agnes_2020(The boys teased the new girl till she loosened up around them.)
- make dem insult person for im front or back
- De bus drivers dem yab de soldiers well-well, but na after dem don go sha. — NSC_Agnes_2020(The bus drivers really insulted the soldiers; after they had left though.)
- Say Anita dey yab Chuks today, na because de guy don fashee her side — NSC_Agnes_2020( Anita is insulting Chuks now because he broke up with her. )
- make dem pass judgement on sometin wey person do or no do
- Some press people work na just to dey yab de government — NSC_Agnes_2020( All some pressmen do is criticize government )
- De way the principal dey yab Mr Johnson since dem make am im Vice show say he no like de man — NSC_Agnes_2020( It is obvious the Principal doesn't like Mr Johnson, his new Vice, judging from his criticism )
Related forms
Synonym
- insult
Translation
tease, criticize, insult