yeye

Naija

Etymology

From: unknown

Pronunciation

  • jɛ̀jɛ́

Play Play

Adjective

  • Make person or ting no get level or better quality.
  • Yeye man.  — (deuber__1834, A useless man.)
  • De give you money make you buy car, you carry money go buy yeye jalopy.  — (You were given some money to buy a car, but you bought a decrepit car!)

Translations

  • English: useless, stupid

Noun

  • Person or someting wey no good at all at all.
  • Babylon people come dey use dem do yeye.  — (jw__15578, The Babylonians maltreated the people.)
  • Make I go fight am? Make e use me do yeye abi? You try, baba. You try.  — (I should go to fight him? So that he'll disgrace me, right? Great idea, sir. Great idea.)

Translations

  • English: maltreatment, disgrace, embarrass

Verb

  • Make de do person someting wey go pain am well well.
  • Na so e dey yeye di pikin cos no be im born am.  — (He/She has been maltreating the child because he/she is not the biological parent.)
  • Di Liverpool striker wey dem just give crown as PFA Player of di Year score two goals, create anoda two for im team mates as Liverpool yeye dia opponents Roma.  — (bbc__31729, The Liverpool player that won the PFA Player award scored two goals, created two assists for his team mates when Liverpool defeated Roma.)

Translations

  • English: maltreat, ill treat