brush

(Redirected from Brush)

Naija

Etymology

From: English brush

Pronunciation

  • brɔ̂ʃ

Play Play

Noun

  1. Wetin get soft chukuchuku wey de join put for wood, plastic or metal wey de fit use clean someting.
    • Dis rug clean well well because dey use brush wash am.  — (This rug is really clean because a brush was used to really scrub it.)
    • De talk sey e good make person dey change im brush if e don use am reach three months.  — (They say it's good for you to change your toothbrush if you have used it for three months.)
  2. Wetin get soft chukuchuku wey de dey use comb head.
    • If you don barb abolo you no go need brush nah.  — (If you have have a skin-cut, you won't have to brush your hair.)
  3. Wetin de dey use dey paint someting.
    • Shey dat painter brush never old like dis?  — (Isn't that painter's brush old?)
    • All dose makeup artists dem, deir brush can dey dear.  — (Those makeup artists have really expensive brushes.)

Translations

  • English: brush, hair brush

Verb

  1. Make person use wetin get soft chukuku wey dey join put for wood or metal use am clean someting.
    • Dis tile, una no go brush am?  — (These tiles, won't you clean them?)
  2. Make person use leg carry anoder person two leg comot for ground make e fall.
    • If you no take time, I go brush you now.  — (If you are not careful, I will kick your legs.)
    • As police catch di guy, omo, de brush di guy once!  —  (Immediately the police caught him, he was cleared off the ground.)
  3. Make dem beat person.
    • E go insult who pass am, de con brush am like who thief money for market.  —  ( He was a beaten like a thief because he insulted a person who was not his peer.)
  4. Make person clean im teeth.
    • No go use bad smell kill person, once you wake go brush abeg.  — ( Don't kill people with a foul odour, as soon as you wake up please brush your teeth.)

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English:brush, beat