charge

(Redirected from Charge)

Naija

Etymology

Fom English: charge

Pronunciation

  • tʃâdʒ

Play Play

Noun

  1. Money wey person go pay for someting.
    • CBN say dis new order go help customers get sharp sharp solutions to some bank wahala like excess charge, withdrawal wey dem no use dia hand do and other things.  — (bbc__24037, The CBN believes the new directive would help reduce banking irregularities such as excess or error charges.)
  2. Case wey government put for person head wey go make dem carry di person go court.
    • Authorities nack am charge say im carry dash Grace di degree.  — (bbc__18064, She/He was held culpable for certificate forgery for awarding a degree to Grace.)
    • Goment put charge of terrorism and oda crimes dem for dia head.  — (bbc__14671, They were accused of terrorism and related crimes.)
    • Di charge be say dem do mago-mago and dem put hand to help distribute illegal drugs.  — (bbc__33532, The charges levelled against them were corruption and illicit drug trading.)
  3. Wetin dey happen wey be sey person na im dey run tings.
    • AFP Gabon Vice Presido Pierre-Claver Maganga Moussavou don take charge.  — (bbc__9964, AFP Gabonese Vice President Pierre-Claver Maganga Moussavou has taken control of office.)
    • Im dey take charge of everyting wey we dey do.  — (JOS_14_Chibozor-View-About-Nigeria_MG__26, He is in charge of everything we are doing.)

Related forms

Translations

  • English: cost, accusation, command

Verb

  1. Make person carry anoder person go court or nack am accusation.
    • E charge im papa go court sake of sey small ting e papa don give am dirty slap.  — (He/she took his father to court on the ground of assault.)
    • Uefa don charge Juventus player Cristiano Ronaldo with improper conduct for im goal celebration afta im club beat Atletico Madrid to reach di quarter-finals of the Champions League.  — (bbc__46100, Cristiano Ronaldo who plays for Juventus has been charged for improper conduct by UEFA for his wild celebrations after scoring in his club's triumph over Athletico Madrid to qualify for the Champion's League quarter finals.)
  2. Sey vex dey control person.
    • Di man charge con kill di thief.  — (The man became so infuriated and killed the thief.)
  3. Sey de make person pay for service or for someting.
    • Na two ways DisCos dey take charge pipo for electricity wey dem use.  — (bbc__72138, DisCos have two methods of making people pay for electricity consumption.)
    • Minister of State for Education, Anthony Anwuka, say, as par law, no federal university suppose charge school fees.  — (bbc__67337, The Minister of State for Education, Anthony Anwuka, said that statutorily federal universities are not expected to charge tuition.)
  4. Sey power dey enter someting or person.
    • When e low pass 50 percent try charge am, even if na small.  — (bbc__99788, However little the percentage, charge the battery when it becomes less than 50 per cent.)
    • Dis entrepreneur get one product wey be handbag for women wey fit charge phone.  — (bbc__40558, The salesman has a particular product: a woman's handbag that can power phones.)
  5. Sey person body ready to nack.
    • Your body just touch woman body small fiam e don charge like cha cha battery.  — (Your skin barely touched the woman's body before your body became aroused like the battery of a new car.)

Translations

  • English: to sue/charge someone, to be infuriated, to charge a fee/payment, arouse