body

Naija

Alternative forms

  • bodi

Etymology

From: English body

Pronunciation

  • bɔ̀dí

Play Play

Definition

  • Any kind ting wey fit dey hold somting.

Noun

  1. Na human being or animal flesh.
    • Na de next day I begin feel pain for all my body after I fall from Okada.  —  NSC_Legbeti_2021. I began feeling pains after I fell from the bike.)
    • How body?  — (IBA_41_Christ-Passion-Finale_MG__40, How are you?)
    • E be like say I no sleep well yesterday because since morning na im all my body dey pain me.  — (NSC_Legbeti_2021.It looks like I didn't sleep well .)
  2. Na container wey dey hold every oder ting.
    • No worry about wetin dem write for moto body, just enter.  —  NSC_Legbeti_2021. Disregard the inscriptions on a bus, just board it.)
    • No let oil pour for de body of de container as you dey turn de oil inside.  —  NSC_Legbeti_2021. Ensure you do not stain the oil container as you turn oil into it.)
  3. Na group wey people form to dey do someting togeder.
    • Na all de different women body join go government house for women day.  —  NSC_Legbeti_2021. All the different women organization went to the government house.)
    • Every State Government— go make am easy for voluntary organisation and oder body wey dey provide service wey State Government get power to provide as e be for section 177, 178, 182 and 183 for dis Act;  — (childrights__525, __Every state government will make it easy for voluntary organisations and other organisations providing services under the authority of the State Government as stated in section 177, 178, 182 and 183 in this Act__)
  4. Na di main ting wey person wan yarn.
    • Di body of wetin I wan yan be sey make we no dey waka for night  — NSC_Ajede_2020. The main point of what I want to say is that we should not walk in the night.)
    • No worry about wetin dem write for moto body, just enter.  — (NSC_Legbeti_2021. Disregard the inscriptions on a bus, just board it.)
  5. Na de law or people wey dey make di law.
    • Na all de country dem join put hand for dis join body agreement .  — (bbc__5952. It was a collective decision by all the countries involved)
  6. Na when person don add weight.
    • You go shock If you see Mama Seyi now, she don get body, come fine.  — (NSC__2021. Seyi's mother nw looks fine and chubby.)
    • Me I no like men wey no get body.  — (NSC_2021. I dislike slim guys.)

Related forms

pepper body, scatter body, body language, body pain, dead body, body parts, body odour, body clock

Synonymes

Antonymes

Translations

  • English: human physical frame, gained weight, the main issue