mind

Naija

Etymology

From: English mind

Pronunciation

  • máìnd

Play Play

Noun

  1. Wetin person take dey reason and tink tings.
    • Me I know say na good mind I take dey follow everybody for dis my life.  — (My thoughts towards all men are pure and good)
    • But men mind dey different.  — (KAD_03_Why-Men-Watch-Football_MG__71, But men think differently.)
    • Because of sey Nigeria school no gree take am, Vitalis put mind and body for wetin im sabi pass - sport.  — (bbc__19389, Vitalis focused on sports when he couldn't gain admission into Nigerian schools.)
  2. Sey people dey do tings togeder.
    • Na God we dey beg make e help us fit get one mind for dis family.  — (It is our prayer dat God helps us live in unity in this family.)
    • Nothing sweet pass one mind for dis life.  — (In this life, unity of purpose is the best.)
    E suppose make sense make people sey dey di same house get di same mind.  — (People who live in the same house should have similar ideas.)
  3. Sey wetin person tink about someting or person.
    Dem tell BBC Pidgin dia mind.  — (bbc__23694, They gave BBC Pidgin their Opinion.)
    • We fit talk our mind now before di money come?  — (Can we say our opinion before the money is paid?)
  4. Sey make person get courage and fit do strong ting.
    • E kill big snake, e really get mind I beg.  — (He actually is bold to have killed a snake.)
    • No be sey di matter hard like that, but na if your mind carry am na im be di ting so.  — ( It is not that the matter is tough, but your possession of the issue is that the courage needed is in doubt.)

Related forms

Synonyms

Translations

  • English: opinion, courage, mind

Verb

  • Make person dey reason someting.
  • Me I fit fight anybody wey insult my mama. I no mind who di person be.  — (I will fight whoever insults my mother regardless of who the person is.)
  • No mind am.  — (ENU_16_Fishfarm_DG__173, Don't mind him.)
  • My papa no mind am, e continue to dey give magazine to people wey gather.  — (jw__27802, My father ignored him and continued sharing the magazine to everyone gathered.)
  • Abeg leave my daughter make you mind your own business.  — (Please mind your business nd leave my daughter alone.)

Synonyms

Translations

  • English: disregard or ignore

Idiom

  • De dey use am talk of someting wey dey disturb person for mind wey de make am worry or tink.
  • O boy my mind no reach ground at all. Evryting just tire person.  — (Dear friend I am really worried. I am tired of everything.)
  • My wife dey hospital as I dey yarn with you so. My mind dey up and I dey find money wey I go give dem for hospital.  —  (My wife is at the hospital. I am so worried and I need money to settle the hospital bills.)