bush pig

Naija

Etymology

  • From: English bush pig
  • Potamochoerus larvatus

Pronunciation

  • búʃpîg

Play Play

Noun

  1. Animal wey follow for pig family wey dey stay for inside bush.
    • Even if I wan chop pig meat, e gats be bush pig.  — (Even if I want to eat pork meat, it has to be pork meat gotten from the bush pig.)
    • Bush pig fit kill person o.  — (Humans can be killed by a bush pig. )
  2. Name wey dey use insult person wey mean sey di person no dey do like who sabi city life. De fit still use am insult person sey e dey dirty well well.
    • No do like bush pig for here. De no dey put bread for inside tea for here... Na play I dey play! Na your money! Chop di bread as you like.  — (Don't behave like an uncultured person here. You don't dip your bread in tea here... I'm only joking! You paid! Eat it however you want.)
    • You be correct bush pig! Toothpaste don finish for your house? Abi you and soap dey quarrel?  — (You are a dirty person! Don't you have toothpaste? Do you have a quarrel with soap?)

Related forms

Translations

  • English: bush pig (Potamochoerus larvatus), uncultured person, dirty person