charge

Revision as of 23:39, 24 August 2021 by 197.210.29.233 (talk) (→‎Verb)

Naija

Etymology

Fom English: charge

Pronunciation

  • tʃâdʒ

Play Play

Noun

  1. Money wey person go pay for someting.
    • Wetin dem charge you for dat coat?  — (Egbokhare_2021, How much were you charged for the suit?)
    • CBN say dis new order go help customers get sharp sharp solutions to some bank wahala like excess charge, withdrawal wey dem no use dia hand do and other things.  — (bbc__24037, the CBN believes the new directive would help reduce banking irregularities such as excess or error charges.)
  2. Accusation wey de dey give person wey de catch sey e do wrong ting.
    • Authorities nack am charge say im carry dash Grace di degree.  — (bbc__18064, S/He was held culpable for certificate forgery in awarding a degree to Grace.)
    • Goment put charge of terrorism and oda crimes dem for dia head.  — (bbc__14671, They were accused of terrorism and related crimes.)
    • Di charge be say dem do mago-mago and dem put hand to help distribute illegal drugs.  — (bbc__33532, The charges levelled against them were corruption and illicit drug trading.)
  3. Control
    • AFP Gabon Vice Presido Pierre-Claver Maganga Moussavou don take charge  — (bbc__9964, AFP Gabonese Vice President Pierre-Claver Maganga Moussavou has taken control of office.)
    • Im dey take charge of everyting wey we dey do.  — (JOS_14_Chibozor-View-About-Nigeria_MG__26, He is in charge of everything we are doing.)
  4. Man prick wey ready to nack.
    • Na small rocking dem rock you, your body don charge .  — (NSC_2021, You are already aroused and you were just danced on.)

Related forms

Translations

  • English: cost, accusation, command, arousal

Verb

Make person carry anoder person go court.

    • E charge im papa go court sake of sey small ting e papa don give am dirty slap.  — (Egbokhare_2021, He/she took his father to court on the ground of assault.)
    Dem no gree charge dem wit anytin but right now di court don grant dem bail sha.  — (bbc__1234, __no translation__)
    • Di man charge con kill di thief.  — (The man was infuriated and then he killed the thief..)
  1. Payment/fee
    • Na two ways DisCos dey take charge pipo for electricity wey dem use.  — (bbc__72138, __no translation__)
    • Minister of State for Education, Anthony Anwuka, say, as par law, no federal university suppose charge school fees.  — (bbc__67337, __no translation__)
  2. power
    • When e low pass 50 percent try charge am, even if na small.  — (bbc__99788, __no translation__)
    • She no see way charge her phone as di plane bin don shut down.  — (bbc__88749, __no translation__)
    • Di money wey dem pay Ryan no include tax or fees wey agents or lawyers charge, and e don double compare wit before year.  — (bbc__36287, __no translation__)
    • Gang wey dey smuggle people dey charge about $6,000 for one migrant to take go Italy, $4,000 na for transport to Libya.  — (bbc__53484, __no translation__)
    • EPA Ronaldo don score 124 goals for Champions League Uefa don charge Juventus player Cristiano Ronaldo with improper conduct for im goal celebration afta im club beat Atletico Madrid to reach di quarter-finals of the Champions League.  — (bbc__46100, __no translation__)
    • Dis entrepreneur get one product wey be handbag for women wey fit charge phone.  — (bbc__40558, __no translation__)

Translations

  • English: sue, to be infuriated, to charge a fee/payment