Difference between revisions of "chop"

Line 81: Line 81:
  
 
====Synonymes====
 
====Synonymes====
* eat, knack, win,
+
* [[eat]], [[knack]], [[win]]
 +
 
 
====Translations====
 
====Translations====
 
English ''eat''
 
English ''eat''

Revision as of 15:49, 6 October 2020

Naija

Alternative forms

Etymology

Pronunciation

  • ʧɔp

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 126
  • Frequency rank in NSC treebank: 116
  • Frequency in raw corpus: 1731
  • Frequency rank in raw corpus: 220

Definition

Sey person put someting for mouth use all im teeth dem bite dem con swallow dem.

NOUN

  1. Food wey person fit eat
    • AFP Bush meat na correct chop for Nigeria  — (bbc__9800, Bush meat is a really nice meal )
    • Datti say NEMA plus oda stakeholders wey include local and international NGOs don organise emergency centres, give chop and melecine to displaced pipo.  — (bbc__27134, NEMA and other stakeholders including local and international NGOs have organized emergency centers, giving food, and medicine to displaced people)

Derived forms

chopchop

  1. Food wey person fit chop but no be better food. E fit be food like chinchin, or groundnut. De dey use dis kind food dey wait make better food show.
    • Who buy all dis chop-chop keep for here?  — (NSC_Emeka_2020, Who bought all these munchies and kept them here?)
    • I never chop better tin since morning o, na just dis chop-chop I use take hold body  —  (NSC_Emeka_2020, I haven't eaten any real food since morning, it's just these munchies I've had to hold myself together )
  2. Person wey be sey e dey chop anyhow
    • You don chop rice, chop beans, you want still chop moimoi, chop-chop!  —  (NSC_Emeka_2020, You have eaten rice, eaten beans, you still want to eat moimoi, glutton )

Synonyms

  • Food, munch.

Translations

  • English: food

VERB

  1. Sey person dey eat food.
    • You wan chop?  — (ENU_13_School-Life_DG__34, You wanna eat?)
    • Dat time, I go... I go go chop suya five thousand dey drink anyhow I like.  — (ENU_33_A-Beg_MG__79, At the time, I'd... I'd go and eat suya worth five thousand, drink however I want.)
  2. Sey de don dey use someting and e no con be as e be wen de buy am.
    • See wetin dat guy don do my slippers, slippers wey I never use, e don use am, e don chop.  — (NSC_Emeka_2020, See what that guy has done to me flip-flops, flip-flops that I hadn't used, he has used it and has worn it out.)
    If you blow am too much, e go dey chop for di centre, but if you...  — (LAG_31_Road-Safety_MG__64, If you blow too much air into it, it will come apart in the middle, but if you...)
  3. Sey person collect punishment.
    • Amosun, wey be governor of Ogun State and Okorocha, di Imo State govnor chop di suspension on Friday afternoon for Abuja wia dia party claim say di two members involve for anti-party activities.  — (bbc__14929, Amosun who is the governor of Ogun state and Okorocha, the Imo state governor has received the suspension on Friday afternoon where their pary claims that the two members were involved in anti-party activities. )
    • Siasia also chop fine ontop di mata, Fifa fine am CHF 50,000 wey be $51,025.00. Fifa don tell Siasia about dia decision, di ban go start with immediate effect.  — (bbc__89497, Siasa has also received a fine beacause of the issue, Fifa fined him CHF 50,000 which is $51,025.00. Fifa has told Siasia about their decision, the ban will start immediately. )
  4. Sey person win someting (e fit be money or anyting) from anoder person hand.
    Omo dat guy, if I see dat guy, I will chop im X.  — (KAD_14_Stephen-Silas-Betting_DG__61, Guy, that guy, if I see that guy, I will eat his X.)
  5. Sey people go deceive person.
    • I hear sey person chop one million for dat promo wey dat bank do.  — (NSC_Emeka_2020, I heard that one person won a million naira in the promo that bank did.)
  6. Sey person recieve someting or person experience someting.
    • Dem don also chop yab on top di video from di ChristChurch killings wia 50 Muslims die as dem bin dey pray.  — (bbc__28886, They have also received criticism on the video from the ChristChurch killings where 50 Muslims died as they were praying.)
    • Ghana chop di lowest scores in corruption perception with 40 points, den drop 11 places for 2016 ranking to 81 out of 180 countries for di 2017 Corruption Perception index.  — (bbc__57390, Ghana has obtained the lowest scores in corruption perception with 40 points, then dropped 11 points in the 2016 ranking to 81 out of 180 countries in the 2017 corruption perception index.)
  7. Sey person/someting collect money wey no be im own / Sey person steal money from govment or for where e dey work or for person business.
    • Tori be say di former Attorney-General suppose face all di government and public officials, wey dey power before or dey inside office now, wey fit don chop di country money.  — (bbc__94982, The story is that the former Attorney-General is supposed to face all the government officials who were in power before or who are in office now, who may have embezzled the country's wealth.)
  8. Sey na di price wey de take do or buy someting
    • Dis election chop more than $3billion wey dem use for just media.  — (bbc__40547, This election has gulped more than $3 billion which they used for just media. )
  9. Sey person knack.
    • Ogbeni, hold yourself, no be every woman you see you go chop.  — (NST_cleaned__27191, Boy, control yourself, it is not every woman you see you'll just have sex with.)
  10. Sey person dey gain someting.
    Sey na dem dey make money pass, sey di man con dey chop for under deir hand.  — (NST_cleaned__518, That they are the ones who are making more money, that he man was making a living from them.)
    If you no monitor am well hm, my sister, make I no deceive you, people go chop you.  — (NST_cleaned__8459, __no translation__)
  11. Sey person dey work de dey pay am
    I don chop money for dis Nigeria, chop money for South Africa, chop money for everywhere.  — (NST_cleaned__20267, __no translation__)
    Tori be say Mr Mamic, im brother Zoran and two other people dey chop money from transfer deals for Dinamo players.  — (bbc__94802, __no translation__)
  12. Sey bad ting happen and people die put.
    Militants attack for Nigeria don reach 9 years since e start for northern part of di konrti and e chop pass 20, 000 pipo head.  — (bbc__67203, Militants attack in Nigeria has lasted for nine years since the start in the northern part of the country and it has consumed 20,000 lives.)


Derived forms

Chop mouth

  1. Sey person mouth no strong put for wetin e dey talk
    Wetin you dey talk? If you want cry, cry. No come here con dey talk dey cry, dey chop mouth like pikin.
  2. Sey person dey talk nonsense
    We dey talk about football team you dey chop mouth dey mention Chelsea. Dat one na team?
  3. Sey person kiss person
    me and dat babe don chop mouth o

Synonymes

Translations

English eat