chop mouth

Naija

Etymology

From: Naija chop

Pronunciation

t͡ʃɔ̀p máùt Play


Verb Phrase

  1. Make person no dey talk come outside wellwell/ Make person word no clear.
    Wetin you dey talk? If you want cry, cry. No come here con dey talk dey cry, dey chop mouth like pikin  —  (What are you saying? If you want to speak, speak, if you want to cry, cry. Don't come here, crying and biting your lips.)
  2. Make person dey do like sey im know di lyrics.
    Una choir members na minus 1, de just dey chop mouth.  —  (Your choristers can't really sing, they barely know the lyrics.)
  3. Make person dey talk nonsense.
    We dey talk about football team you dey chop mouth dey mention Chelsea. Dat one na team?  — (Why are you mentioning Chelsea when we are talking about football? Is that even a football team?).
  4. Make person kiss person.
    I catch bros and dat babe dey chop mouth o.  —  (I caught brother and that lady kissing. )
  5. Make person talk wetin no be true.
    Politicians sabi chop mouth for Nigeria.  —  (Politicians lie a lot in Nigeria.)

Antonym

talknado

Translation

English: lip sync, mumble, say nonsense, kiss, lie