cost

Revision as of 21:41, 3 May 2023 by Emeka (talk | contribs) (→‎Verb)

Naija

Etymology

From: English cost

Pronunciation

  • kɔ́s

Play Play

Verb

  • Make person go do or give make e get anoder ting.
  • I no mind wetin e go cost, make you sha make sure sey I win di election  — (Regardless of the cost, just ensure I win the election.)
  • E no even reason wetin e go cost am, e just put body.  — (He didn't care about the consequences he just got himself involved.)
  • Make someting make person no get wetin e suppose get.
  • Dis one show say the Eaglets no take their chances at all and e con cost dem.  — (brila__1167, The Eaglets failed to take their chances and consequently lost the match.)
  • I no put head down learn English for school and di ting cost me later for life.  — (I wasn't serious with learning English while in school and it became one grave mistake later in life.)

Translations

  • English: consequence, loss

Adjective

  • Sey money for someting too plenty.
  • Di cream cost o.  — (Egbokhare_2020, The cream is expensive.)
  • E cost.  — (KAD_01_Students-Life_DG__77, it is expensive.)
  • Wetin make am cost like dat?  — (LAG_28_Buying-Shawarma_DG__87, Why is it so expensive?)
  • Some sef no fit use kerosene because kerosene don cost.  — (LAG_05_Government-Dey-Try_M__65, Some others cannot even use kerosene because kerosene is now expensive.)
  • To friend girls for here no cost like dat.  — (NSC_2021, To date girls here is not that expensive.)

Related forms

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: expensive