enhen
Naija
Alternative forms
Etymology
Pronunciation
Play
Play
Interjection
- Word wey person dey use if e wan say person no fit do am anyting.
- Enhen? — So what?)
- Enhen, wetin you fit do me? — (So what can you do to me by the way?)
- Word wey person dey use if someting shock am.
- Enhen, So, Papa fit dash mama dat im new jeep?! I shock o. — (Unbelievable! So Dad could actually give his new SUV to mum? I'm stunned.)
- Enhen? Jesu! — (Really?! dear Lord!)
- Word wey person dey use if person no too believe wetin im hear.
- Enhen? I no believe. So, dat stingy man fit ever dash person money like dat? — (Really? Its hard to believe that stingy man can releases a dime to anyone!)
- Enhen?, you mean am true true say na that small Olise na im get all dis fine fine house dem?! — (Really? you mean its dat young Olise that really owns this estate?!)
- Word wey person dey take show sey person no like wetin don or dey happen.
- Enhen? Na so we go dey look, everyting go dey spoil dey go for dis country?! — (Really? so we are helpless over the state of things in dis country?)
- Enhen, Chichi, so me and you don become mate for dis house sotey I dey talk, you dey hiss? — (So Chichi, you no longer respect me, you now hiss while i'm talking, really?)
- Word wey person dey use if someting sweet am.
- Enhen? Na so life dey sweet if person sabi book? see me, see London?! — (Oh dear Lord! Never knew life could be this easy if one is academically brilliant. Now im on my way to London!)
- Ten million Naira for me? Enhen, my in-law, Na now you talk wetin I wan hear. — (I will get Ten million nira? Now you are doing the right thing my in law!)
- Word wey person dey use if person wan talk say 'na im good for you'.
- Enhen, God don catch am! — (Good for him!)
- Enhen, my head don catch am! — (Good! my God has dealt with him since I can't!)
Translations
- English: Exclamation for - disregard, surprise, amusement, disbelief, agreement