enhen
Naija
Alternative forms
Etymology
- From: unknown
Pronunciation
- ɛ̀hɛ̃
Interjection
- Word wey person dey use if e wan say person no fit do am anyting or'and so what?'
- Enhen? — (Egbokhare_2020. So what?)
- Enhen, wetin you fit do me? — (NSC_Legbeti_2021. So what can you do to me by the way?)
- Word wey person dey use if someting shock am.
- Enhen, So, Papa fit dash mama dat im new jeep?! I shock o. — (NSC_Legbeti_2021. Unbelievable! So Dad can really give mum his new jeep?)
- Enhen? Jesu! — (NSC_Legbeti_2021. For really?! dear Lord!)
- Word wey person dey use if person no too believe wetin im hear.
- Enhen? I no believe. So, dat stingy man fit ever dash person money like dat? — (NSC_Legbeti_2021. Really? Its hard to believe that stingy man can releases a dime to anyone!)
- Enhen?, you mean am true true say na that small Olise na im get all dis fine fine house dem?! — (NSC_Legbeti_2021, Really? you mean its dat young Olise that really owns this estate?!)
- Word wey person dey take show sey person no like wetin don or dey happen.
- Enhen? Na so we go dey look, everyting go dey spol dey go for dis country?! — (NSC_Legbeti_2021, Really? so we are helpless over the state of things in dis country?)
- Enhen, Chichi, so me and you don become mate for dis house sotey I dey talk, you dey hiss? — (NSC_Legbeti_2021, So Chichi, you no longer respect me, you now hiss while i'm talking, really?)
- Word wey person dey use if someting sweet am.
- Enhen? Na so life dey sweet if person sabi book? see me, see London?! — (NSC_Legbeti_2021, Oh dear Lord! Never knew life could be this easy if one is academically brilliant. Now im on my way to London!)
- Ten million Naira for me? Enhen, my in-law, Na now you talk wetin I wan hear. — (NSC_Legbeti_2021, I will get Ten million nira? Now you are doing the right thing my in law!.)
- Word wey person dey use if person wan talk say 'na im good for you'.
- Enhen, God don catch am! — (NSC_Legbeti_2021, Good for him!)
- Enhen, my head don catch am! — (NSC_LEgbeti_2021, Good! my God has dealt with him since I can't!)
Translations
- English: Exclamation for - disregard, surprise, amusement, disbelief, agreement