eye

Revision as of 13:24, 7 December 2020 by 89.156.22.234 (talk) (→‎Noun)

Naija

Etymology

From: English eye

Pronunciation

  • áì

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 24
  • Frequency rank in NSC treebank: 401
  • Frequency in raw corpus: 1768
  • Frequency rank in raw corpus: 217

Definition

Wetin person take dey see.

Noun

  1. Di part of person body wey e dey take see someting.
    • My eye dey pain me since morning o  — (NSC__Shulammite_2020_ My eyes have been hurting since morning. )
    • Look the police for eye.  — (jw__2315, Looked at the police officer eye to eye.)
    • Sand don enter im eye as e dey play with sand sand for outside.  — (NSC__Shulammite_2020_ Sand entered his eye while playing with sand outside .)
  2. Di way person dey look something/somebody.
    • Which kind eye we go take look the work wey dem give us?  — (jw__45597, How do we view the work given to us?)
    • Which eye I expect say make e take look me?  — (deuber__6567, How do I expect him to view me?)
  3. na make person learn something well.
    • Put eye down.  — (jw__30546, __pay attention__)
  4. Person wey start dey wise up.
    • As di kele come back from youth service, her eyes con open.  — (NSC_Shulammite_2020, As the young lady returned from youth service, she became exposed.)
  5. Dem dey monitor person.
    • Bros, put eye for your son, I see am dey waka with boys wey dey smoke igbo.  — (NSC_Shulammite_2020. Sir, monitor your son, he is keeping bad company.)
    • E go good make EFCC put eye for all di people wey be say de dey office.  — (LAG_39_Recording-Wahala_T__16, You have started monitoring me.)
  6. Na make person deal with anoder person.
    • E be like sey I go chop people eye.  — (IBA_06_Linguistic-Fieldwork_DG__234, It seems I will deal with some people.)
  7. Condition where person dey vex.
    • Top-flight Spanish Club Barcelona eye dey red.  — (bbc__85344, Top-flight Spanish Club Barcelona are displeased.)
  8. As per person join mouth put for something.
    • Tori be say na sports and politics na im Weah go put eye and mouth ontop.  — (bbc__95224, The main gist is that, sports and politics are what Weah will focus on.)
    • dem wan put eye and mouth, so dat di discussion no go turn to fight-fight.  — (bbc__25440, They want to intervene so that the discussion will not degenerate into a fight.)
  9. Na make person do somtin korokoro.
    • God go punish people wey open eye do wetin e no like.​—  — (jw__32645, God will punish those who intentionally do what he dislike.)
  10. Na make people reason togeda.
    • Like Saraki, Kwankwaso comot from APC and re-join PDP wen im stop to dey see eye to eye wit di way di party dey waka.  — (bbc__63889, Like Saraki, Kwankwaso left from APC and re-joined PDP when he stopped agreeing with the manner in which they run the party.)
  11. Person don experience someting.
    • If you don see love before eye too eye, if you don see love before, you go know sey love dey exist.  — (NST_cleaned__18824, If you've come face to face with love, if you've experienced it before, you'll know that love is real.)
  12. Person wey know how tings dey go.
    • Di plenti waka waka, as e no di stay for kontri don make pipo di shine eye for weti e di do.  — (bbc__27632, His many travels has made people in the country curious.)

Related forms

Synonyms

Translations

  • English: eye, stare, greedy, smart, aware

Verb

  1. Make person dey person one kind one kind.
    • For di meeting today ehn! na so dem begin to dey eye demsef  — (NSC__Shulammite_2020_ During the meeting today, they were making faces at each other.)
  2. Make person dey get longer throat for someting.
    • Saraki na number three oga for Nigeria goment and e be like say im dey eye to be Presido.  — (bbc__87021, Saraki is the third highest officer in Nigeria government, but it seems he wants to contest for the post of the president.)

Adjective

  • Some men na big eye dem get,  — (NST_cleaned__14300, Some men are just greedy.)

Related forms

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: making faces, greedy