eye

Naija

Etymology

From: English eye

Pronunciation

  • áì

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 24
  • Frequency rank in NSC treebank: 401
  • Frequency in raw corpus: 1768
  • Frequency rank in raw corpus: 217

Definition

Wetin person dey take see light.

Noun

  1. Di part of man body wey e dey take see tings well.
    • My eye dey pain me since morning o  — (NSC__Shulammite_2020_ My eye had been paining me since morning. )
    • Look the police for eye.  — (jw__2315, He looked at the police officer eye ball to eye ball.)
    • Stone don enter im eye as e dey play with sand sand outside.  — (NSC__Shulammite_2020_ Stone particles had entered his eye while playing outside with sand.)
  2. Di wey person dey look something/somebody.
    • Which kind eye we go take look the work wey dem give us?  — (jw__45597, How do we view the work given to us?)
    • Which eye I expect say make e take look me?  — (deuber__6567, How do I expect him to view me?)
    Put eye down.  — (jw__30546, __no translation__)
  3. Person wey start dey wise up.
    • Come dey open eye small.  — (WAZK_10_Muhammeds-Life-Story_M__19, Then, I started seeing thing from my different perspective.)
  4. Dem dey monitor person waka waka.
    • You don dey put me for eye.  — (LAG_39_Recording-Wahala_T__16, You have started monitoring me.)
  5. Person deal with anoder person.
    • E be like sey I go chop people eye.  — (IBA_06_Linguistic-Fieldwork_DG__234, It seems I will deal with some people.)
  6. Condition where person dey vex.
    • Top-flight Spanish Club Barcelona eye dey red.  — (bbc__85344, Top-flight Spanish Club Barcelona, is in a provoked state.)
  7. As per person join mouth put for something.
    • Tori be say na sports and politics na im Weah go put eye and mouth ontop.  — (bbc__95224, The main gist is that, we are only supporting sports and politics.)
    • dem wan put eye and mouth, so dat di discussion no go turn to fight-fight.  — (bbc__25440, They want to participate in the discussion, to avoid any argument and fight.)
  8. Person dey do watin dem know sey e bad.
    • God go punish people wey open eye do wetin e no like.​— Heb.  — (jw__32645, God will punish those who intentionally do what he hates.)
  9. Person no gree with something/person.
    • Like Saraki, Kwankwaso comot from APC and re-join PDP wen im stop to dey see eye to eye wit di way di party dey waka.  — (bbc__63889, Like Saraki, Kwankwaso left from APC and re-joined PDP when he stopped agreeing with the manner in which they run the party.)
  10. Person don experience someting.
    • If you don see love before eye too eye, if you don see love before, you go know sey love dey exist.  — (NST_cleaned__18824, If you've come face to face with love, if you've experienced it before, you'll know that love is real.)
  11. Person wey know how tings dey go.
    • De plenti waka waka, as e no di stay for kontri don make pipo di shine eye for weti e di do.  — (bbc__27632, His unavailability in the country, has made the citizen curious of his affairs.)
    • All kontri dem need for look for how their future go be, shine eye for educate young pipo, especially girl pikin dem, e bi important for promote stem education for girls.  — (bbc__300, The country needs to look for ways to ensure her future, by paying attention to the education of the young people, especially the girl child. It is important to promote the girl child education.)
  12. Person dey focus on top one matter.
    • Auba continue di new campaign from where im stop di last one - with im movement wey no dey end and sharp eye for goal to strike reach eight times for di first six games wey di league play.  — (bbc__8664, Auba continued his new campaign from where he stopped the last one. With his unending movement and focus on how to score goals up to eight times for the first six games of the league played.)

Derived forms

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: eye, stare, greedy, smart, aware


Verb

  1. Make person dey look sombody wan kain wan kain.
    • For di fight today ehn! na so dem begin to dey eye dem sef  — (NSC__Shulammite_2020_ During the fight today, they started making faces at each other.)y
  2. Make person dey get longer throat for someting.
    • Saraki na number three oga for Nigeria goment and e belike say im dey eye to be Presido Supreme Court don pass judgement say senate president Dr.  — (bbc__87021, Saraki is the third most ranked person in Nigeria government, and it seems as if he wants to contest for the post of the president. the Supreme Court has passed the verdict..)
    • Some men na big eye dem get,  — (NST_cleaned__14300, Some men are just greedy.)


Derived forms

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: making faces, greedy