fashi
Naija
Alternative forms
Etymology
From: Unknown
Pronunciation
- fáʃì
Verb
- Make person waka leave someting follow anoda way.
- E be like sey di union don fashi de struggle o. — (NSC_2020, It seems like the union has abandoned the struggle.)
- If de no invite you, you no go fashi dem go your house go sleep? — (NSC_2022, If they don’t invite you, won’t you ignore them, go to your house and then go to sleep?)
- Make person end all talk talk for matter.
- Di ref give dem wayo, fashi!. — ( Egbokhare_2020, The Referee awarded an unmerited win to them, Forget it!)
- fashi!, I no go ever fit chop Pizza belleful, I be kpako boy. — (NSC_2020, Forget it, As a local chap, Pizzza is not a full meal for me.)
- Make person no too put mind for matter.
- Ken too dey form serious, tell am make e dey fashi many tings smallsmall. — (NSC__2020, Ken is always too serious, tell him to relax.)
Synonyms
Translations
- English: neglect, abandon, ignore
Interjection
- Word wey person dey talk to take show sey e want end talk talk for matter.
- Di ref do dem wayo, fashi!. (The referee cheated them, forget it!)
Fashi!, I no go ever fit chop pizza belleful, I be kpako boy. (Forget it, as a local chap, pizzza is not a full meal for me.)