ground

Naija

Etymology

From: English ground

Pronunciation

  • grănd


Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 45
  • Frequency rank in NSC treebank: 262
  • Frequency in raw corpus: 1245
  • Frequency rank in raw corpus: 299

Noun

  1. Na dat part of dis world wey dem dey waka ontop.
    • E come fall for ground.  — (jw__5558. It fell on the surface of the earth.)
    • As de boy just dey ground dey shake because of de epilepsy, de oder children begin fear, nobody gree go near am.  — (NSC_Legbeti_2021. As the boy fell down and began shaking badly from epilepsy, the other kids got scared and didn't dared go near him.)
  2. Na make person dey available for anyting wey wan happen.
    • Na we dey ground.  — (LAG_38_Elections_DG__75. We are the people available.)
    • Me I don let dem know say I full ground remain.  — (NSC_Legbeti_2021. I have already informed them that I am very much available.)
    • I dey o, I dey full ground.  — (WAZL_06_Na-Your-Health_DG__10, I am fine, I am very fine.)
  3. Na when matter dey wey never get head.
    • Na im make trouble full ground.  — (jw__25707. That is why issues are on ground.)
    • Oga, wahala full ground remain.  — (jw__25707. There are lots of unresolved issues on ground boss.)

Verb

  • Na situation wey be say e still dey happen.
  • Confusion bin dey ground as to weda pipo die;  — (bbc__26119. It was unclear whether there were casualties or not.)
  • Soldiers and police dey ground to control di protests  — (bbc__90798. The Soldiers and Police are ready to prevent riot from breaking out.)
  • Plenti tori dey ground for how di soldier take die.  — (bbc__82045. There are different accounts on the death of the soldier. )
  • If na for di matter wey dey ground na im you wan put mouth, put mouth.  — (WAZK_09_Fuel-Price-Increase_M__84, If it's the matter on ground that you wish to have input, go ahead.)

Related forms

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: surface of the earth.. matter at hand