jam
Naija
Etymology
From: English jam
Pronunciation
- dᶚám
Verb
- Na make dem use people head knock each other.
- I no sabi jam people head togeder I beg. — (NSC_Legbeti_2021. Please I dont know how to turn people against each other.)
- So, you no quick see say Chichi wan jam your head with Chuks head make una for no fit marry if not sey God pass am?. — (NSC_Legbeti_2021. So, but for God, you almost didnt realize Chichi's plan was to upturn things and prevent the marriage between you and Chuks?)
- Na make body touch body.
- Oga, I no like di way your body dey jam my body for dis Molue o shift go back small biko. — (NSC_Legbeti_2021. I detest the way your body rams into mine from behind in this bus, kindly adjust please.)
- When my body jam your own dis night, I swear you no go gree go back dis weekend. — (NSC_Legbeti_2021. When we make love tonight, I am sure you wont leave this weekend. )
- Na make wetin hit pesin spoil someting.
- Who jam your moto for back?. — (NSC_Legbeti_2021. Who hit your car from behind?.)
- Na di day you go jam soldier for road na im you go know say make pesin dey drive one way fit comot teeth. — (NSC_Legbeti_2021. Until the day you run into the army personnel and get beaten, you will not desist from driving against on-coming cars.)
- Na make pesin see someting wey e dey look for or nor look for.
- As I jam Igbo garri for market, I buy three rubber sharpsharp. — (NSC_Legbeti_2021. When I found where the garri from the Igbo area was sold, I bought three measures.)
- As I jam my mama for di show, I pass back comot. — (NSC_Legbeti_2021. When I saw my mother at the show, I went through the back door.)
Synonyms
Translations
- English: Jam
Noun
- Na wetin sweet wey pesin fit take chop bread.
- Di way jam take dey finish for dis house, pesin no know whether spirit dey join us eat am walahi. — (NSC_Legbeti_2021. The rate at which jam is consumed in this house make one doubt the number of persons living in the house. )
- Di first time dis my mout touch jam, only me nearly chop di bottle finish. Di ting sweet die. — (NSC_Legbeti_2021. The first time I ate jam, I almost emptied the bottle, it was so sweet!)
Translations
- English: Jam