touch

Naija

Etymology

From English: touch

Pronunciation

  • tɔ̂tʃ


Verb

  1. Make person carry im hand go meet someting.
    • No touch your radio o.  — (WAZA_12_Lady-G_M__33, Don't touch your radio.)
    • If you touch stove wey dey hot wit your hand, e go burn you o!  — (If you touch a hot stove, you will burn your hand.)
  2. Make person body meet wit anoder person own.
    • Husband and wife fit touch demsef anyhow, e no wrong.  — (A couples are free to engage in all kinds of romance.)
    • Some women ehen, once dem husband touch dem like dis, na belle straight.  — (Some women are very fertile, once they make love with their husbands, they get pregnant.)
  3. Make person try beat or try start fight with anoder person.
    • No touch dat pikin if not you go see my red eye!  — (Don't think of beating that child or you will have me to contend with.)
    • Touch me, and you go know!  — (IBA_41_Christ-Passion-Finale_MG__45, Touch me, and you will know!)
  4. Make someting enter person mind make di person heart soft. / Make person feel for person.
    • Di beggar talk wetin touch me.  — (The beggar's tale broke my heart.)
    • This one go help us touch their heart.  — (jw__37097, This one will help us melt their hearts.)
    • So as to avoid tori wey dey touch.  — (bbc__9317, So as to avoid disruption.)
  5. Make person craze.
    • Dat guy brain don dey touch.  — (That guy has become insane.)
    • No go smoke wetin go make your brain touch.  — (Do not smoke substances that will make you lose your sanity.)

Related forms

Synonyms

Translations

  • English: touch,disrupt, crazy