jazz

Naija

Etymology

From: English jazz

Pronunciation

d͡ʒâz Play Play

Noun

  1. juju wey people dey use de do bad ting.
    • If you dey drive, open eye o. De no dey do jazz for trailer.  — (Drive carefully, voodoo can’t prevent truck accidents.)
    • Di jazz wey dat man do for im oga don clear.  — (The hex the man cast on his boss has waned.)
  2. Make person dey talk wetin no make sense or wetin anoder person no understand.
    • E dey ask you where di money you dey you dey talk jazz. Baba, you collect di money abi you no collect di money?  —  (He is asking you where the money is and you are saying rubbish. Bro, did you collect the money or not?)
    • De say make we come learn business idea. Na im we reach o, de start to say two go bring two, den di two go bring two. Na me by mysef start to laff mysef because na me carry my two leg come dey hear all dis jazz.  —  (They said we should attend so we could learn some business ideas. When we got there they started talking about a pyramid scheme. I started laughing at myself, because I willingly went there to hear all that rubbish.)

Related forms

jazzman

Synonym

juju, charm

Translation

  • English: charm

Verb

  • Make dem do person juju.
  • De talk sey im village people jazz am na im make e no dey fit stay with one woman.  — (People say that he has been enchanted, that's why he is promiscuous.)
  • Dat place where you dey always go, de fit don jazz you.  — (That place you always go to, you may be under a spell.)

Synonym

charm,

Translation

English: hex, enchant, cast spell