look

Naija

Alternative forms

Etymology

From: English look

Pronunciation

  • lûk

Play Play

Verb

  1. Make person dey take eye see someting wey dey im front.
    • Look my cloth.  — (deuber__3577, Look at my cloth.)
    • So I dey look am, dey look am.  — (ENU_37_Dmoris-Restaurant_MG__135, Then, I just kept staring at him.)
  2. Make person carry mind put ontop someting wey never happen.
    • Dey look eh, God go catch you!  — (deuber__553, Just wait and see, you will meet nemesis.)
    • Look, I don pack my bag.  — (deuber__5739, See, I have my bag packed.)
  3. Make person get as e be.
    • You wan look fine.  — (NST_cleaned__25598, You want to look good.)
    • In fact deir friends go make am look like sey you no know what's up if you no dey cheat.  — (IBA_03_Womanisers_MG__41, Actually, your friends will make it appear as if you have not wised up if you choose not to cheat.)
  4. Make person check person or see as someting be true true.
    • Go look if your papa done bring out yam for afternoon.  — (katakata__1060, Go and check whether your father has brought the yam out for lunch.)
    • We go tok some of dia tori dem for hia and look how dem take report di tori dem.  — (bbc__18204, We are going to focus on the headlines and analyse the reportage.)
    • Anytime you enter dis hood just hala, look for Monday.  — (KAD_16_Driver-Mechanic-Talk_DG__182, Whenever you are in this neighborhood, just put a call through and look for Monday.)

Synonyms

Translations

  • English: look, appear, pay attention, examine