oil

Naija

Etymology

From: English oil

Pronunciation

  • ɔ́jɛ̀

Play Play

Noun

  1. Water water ting wey thick wey de dey use cook.
    • Na only from supermarket I dey buy de oil wey I dey take make my stew.  — (I buy the oil I cook my stew with from the supermarket.)
    • E be like sey I still get oil for house .  — (It seems I still have oil at home.)
  2. Black water water ting wey dey for inside ground wey people turn to fuel and kerosine and gas and oder oder tings.
    • Delta no go fit depend on oil forever.  — (bbc__28099, Delta can not depend on fuel forever.)
    • Di small kontri dey rich in oil and gas exports.  — (bbc__20753, The small country is rich in oil and gas export.)
  3. Na liquid wey dem dey use rub body.
    • Na baby oil dey good for harmattan period.  — (Baby oil is better during harmattan.)
    • Use oil and moisturizer for your hair and leg join.  — (bbc__97434, Use oil and moisturizer for both your leg and hair.)
  4. Liquid wey be like grease wey dem dey use for anointing.
    • Anointing oil na im pastors dey pray with, no be groundnut oil.  — (Pastors pray with anointing oil, not groundnut oil.)
    • Okay na anointing oil e go be for sure.  — (It must be anointing oil.)
  5. Someting wey dey make tings dey go well for person.
    • Na your car be dis? 'Oil dey your head, babe  — (This is your car? You have a lot of luck, babe.)
    • Everybody dey hustle, but if oil dey your head e suppose fit make am go well.  — (Everyone is trying to make earns meet, but if you have some luck, it should make it easier.)
    • After you don baff soap finish you say a oil. Shift make we see air wey de pass abeg  — (After you’ve done a good luck charm, you said it’s just your luck. Please get out of the way.)

Related forms

Translations

  • English: lubricant, cooking oil, anointing oil, luck, crude oil