papa
Naija
Pronunciation1
- pàpá
Etymology
From: English papa (old word for father)
Noun
- Na name dem dey call man wey get children.
- Sabo bin dey live wit im mama and papa. — (bbc__86638. Sabo once lived with his parents.)
- Person suppose read books make im for know how to be better papa and mama? — (NSC_Legbeti_2021. It is recommended that one read books on how to be a good parent.)
- As we reach dere, im papa start to dey flog am sotay peopl con dey beg di papa. — (Egbokhare _2020. On arrival, his father began flogging him so much that people had to intervene.)
- Na Unoka be Okonkwo papa. — (katakata__305. Unoka is Okonkwo's father.)
- Waooh, dis papa carry annointing I beg — (NSC_Legbeti_2021. This Pastor is blessed indeed.)
- E don turn papa. — (JOS_26_Small-Talk_DG__96, He has turned a father.)
- Na de person wey be de head of de house.
- As de person wey old pass, na him be papa for everybody for. — (katakata__305. As the eldest in the compound, he is the father of the home.)
- Which advice one brother give the papa of the house? — (jw__45468. Which advice did the brother give the father of the house?.)
- Nobody, no papa, no help. — (ONI_09_Before-I-Marry_M__57, i had noone, no father, no help.)
Related forms
Synonyms
Antonyms
Translations
- English: Father, dad, a pastor
Pronunciation2
pápà
Etymology
From: English papa (old word for father)
Noun
- hailing for who be pastor for church or who get level for di church.
- Tunde go meet papa make e pray for am. — (Egbokhare_2020, Tunde went to meet the pastor to pray for him.)
- hailing for who get mouth for area.
Synonyms
Translation
- English:
Pronunciation3
pâpà
Etymology
From: English papa (old word for father)
Noun
- Name for old man for area
- Dat papa for dat market area sey make una come pluck orange if una want. — (NSC_2021, That Old man who stays around the market said that you can come to pluck oranges if you want.)
- Una go ready, we need go see one papa. Na im be principal for my secondary school dat time. — (NSC_2021, You all need to get ready. We need to visit an elderly man who was my secondary school principal.)
Translations
- English: Elderly man