pure
Naija
Etymology
From: English pure
Pronunciation
- pjᴐ̂
Adjective
- Sey someting no get yamayama.
- Na pure one. — (KAD_19_Kabiru-Gymnasium_DG__144, It is a pure one.)
- E no pure. — (ABJ_INF_03_Nigerian-Men-Dey-Try_DG__11, It is not pure.)
- Sey someting dey original.
- No, no e no pure. — (JOS_07_Trousers-And-Short-Skirts_DG__104, No, no, it is not genuine.)
- Anyanwu also chook mouth say tok say lawmakers dey cut meeting to run dia election parole no pure. — (bbc__15963, Anyanwu commented that the actions of lawmakers by cutting meetings to run the election is not genuine.)
- Nigeria goment don close three pharmaceutical companies wey dem say di way dem dey sell drugs no pure. — (bbc__73727, Nigeria government has closed down three pharmaceutical companies accused of selling fake drugs.)
- Sey bad ting no dey.
- Your heart clean, your hands pure. — (BEN_12_Receiving-From-God_M__41, Your heart is clean, your hands are pure.)
- Sey bad ting no dey happen
- Make Naija for better, make di street for pure, — (ABJ_INF_11_Land_M__62, Let Nigeria be a better place. Let the streets be safe.)
- Sey person no dey straightforward.
- Today na Lola, tomorrow na Jude, but Jude way no pure. — (JOS_31_Psqaure-And-Efe_DG__35, Today it is Lola, tomorrow it is Jude. But Jude's ways are not straightforward.)
- When someting no make sense.
- E no pure at all, e no pure. — (JOS_07_Trousers-And-Short-Skirts_DG__106, It doesn't make any sense at all; it doesn't make any sense.)
- And dat one no pure too. — (JOS_07_Trousers-And-Short-Skirts_DG__138, And that doesn't make any sense too.)
- For dis wey we dey talk so, e no, e no straight, e no pure at all. — (NST_cleaned__19462, The way we are talking, is not straight, is not making any sense.)
- Collect money wey dey illegal.
- Dis na some of di money wey Nigerians dey pay wey no pure. — (bbc__41691, These are some of the money Nigerians pay that are illegal.)
- Charge 2: Im collect cash money wey no pure of up to $5,000,000 from former Minister of State for Defence Senator Musiliu Obanikoro in June, 2014. — (bbc__25122,Charge 2: He illegally collected cash of $5,000,000 from former Minister of State for Defence, Senator Musiliu Obanikoro in June, 2014.)
Synonyms
Translations
- English: pure, genuine