pure

Naija

Etymology

From: English pure

Pronunciation

  • pjʊr

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 6
  • Frequency rank in NSC treebank: 1052
  • Frequency in raw corpus: 175
  • Frequency rank in raw corpus: 1448

Adjective

  1. Sey someting no get yamayama.
    • Na pure one.  — (KAD_19_Kabiru-Gymnasium_DG__144, It is a pure one.)
    • E no pure.  — (ABJ_INF_03_Nigerian-Men-Dey-Try_DG__11, It is not pure.)
  2. Sey someting dey original.
    • No, no e no pure.  — (JOS_07_Trousers-And-Short-Skirts_DG__104, No, no, it is not genuine.)
    • Anyanwu also chook mouth say tok say lawmakers dey cut meeting to run dia election parole no pure.  — (bbc__15963, __no translation__)
    • Nigeria goment don close three pharmaceutical companies wey dem say di way dem dey sell drugs no pure.  — (bbc__73727, __no translation__)
    • goddess wey only wan tins wey pure.  — (bbc__8636, __no translation__)
    • But clearly, some oda tins wey no pure bin dey happun inside di place.  — (bbc__26942, __no translation__)
  3. Sey bad ting no dey.
    • Your heart clean, your hands pure.  — (BEN_12_Receiving-From-God_M__41, Your heart is clean, your hands are pure.)
  4. Sey bad ting no dey happen
    • Make Naija for better, make di street for pure,  — (ABJ_INF_11_Land_M__62, Let Nigeria be a better place. Let the streets be safe.)
  5. Sey person no dey straightforward.
    • Today na Lola, tomorrow na Jude, but Jude way no pure.  — (JOS_31_Psqaure-And-Efe_DG__35, Today it is Lola, tomorrow it is Jude. But Jude's ways are not pure.)
  6. When someting no make sense.
    • E no pure at all, e no pure.  — (JOS_07_Trousers-And-Short-Skirts_DG__106, It doesn't make any sense at all; it doesn't make any sense.)
    • And dat one no pure too.  — (JOS_07_Trousers-And-Short-Skirts_DG__138, And that doesn't make any sense too.)
    • For dis wey we dey talk so, e no, e no straight, e no pure at all.  — (NST_cleaned__19462, __no translation__)
    • Nigeria army use Trump video to defend why dem shoot Shia protesters Shiite: Wetin Amnesty tok about Abuja kwanta no pure - Police  — (bbc__73392, __no translation__)
  7. Collect money wey dey illegal.
    • Dis na some of di money wey Nigerians dey pay wey no pure.  — (bbc__41691, __no translation__)
    • Charge 1: Im collect money wey no pure of up to N1,219,000,000 wey im use sponsor im own govnorship election for Ekiti in June, 2014 Charge 2: Im collect cash money wey no pure of up to $5,000,000 from former Minister of State for Defence Senator Musiliu Obanikoro in June, 2014 Charge 3: Im keep N300,000,000.00 for fixed deposit bank account wey no follow law Charge 4: Togeda wit Spotless Ltd.  — (bbc__25122, __no translation__)


Synonyms

Translations

  • English: pure, genuine