scope

Naija

Etymology

From: English scope

Pronunciation

  • skôp

Play

Verb

  1. Make person tell anoder person someting wey no be true.
    • Abeg, no scope me. Give me di money.  — (Please do not lie to me. Let me have the money.)
  2. Make man dey try tell woman wetin go make di woman gree make two of dem dey like like deirsef.
    • After you don scope di babe finish now, she gree?  — (After you've wooed the lady, did she say yes?)
    • How many babes you don scope dis week? De go gader beat you o. No go scope person wife.  — ( How many ladies have you wooed this week? They'll all come around to give you a beating. Make sure you don't woo someone's wife.)

Translations

  • English: lie, woo

Noun

  • Wetin person tell anoder person wey no be true.
  • You just dey talk supri supri dey give dem scope.  — (You were speaking to them like a foreigner, and you were lying.)
  • No give me scope. Just tell me. Wetin really happen?  — (Don't lie to me. Just tell me. What really happened?)

Translation

  • English: lie