show
Naija
Etymology
From English: show
Pronunciation
- ʃô
Noun
- Place where people dey go go groove.
- E, e get one show I no tell you, e get one show for ABJ wey I go for. — (LAG_14_Charles-And-Alfred-On-Music_DG__196, There's a show I didn't tell you about it, it's a show I attended at ABJ.)
- Tiwa perform for di show. — (bbc__94150, Tiwa performed at the show.)
- Programme wey de dey show for tv or radio.
- Padi, padi is di name of di show. — (WAZL_09_Talk-Show-Catman_DG__45, Padi padi is the name of the TV show.)
- Former governor of di state, Donald Duke na one of di biker's wey been dey on show. — (The former governor of the state, Duke was one of the bikers that was frequent on the program.)
Synonyms
Translations
- English: party, programme on the media
Verb
- Make person dey express someting.
- No be im fault. Na wetin you show am e use judge di matter. — (It is not his/ her fault. He/she is considering the matter based on what you showed.)
- Dat man get sense. E no quick gree make di man work for am. E know sey di man go dey show am sey e be better person make e fit get di job. As di man wait small, di man cast imsef. — (The man is wise. He did not immediately agree to employ the man. He knew that the man will pretend to be a good person so that he can get the job. He waited for a while and the man exposed himself.)
- Make truth about someting or person comot.
- But di proof wey dey di mata dey show sey na from cells cancer dey from start. — (bbc__22320, But the evidence shows that cancer starts from the cell.)
- Oga Aleburu dey advice say you fit just search di online vendor on top Google and everything about di company go show. — (bbc__89634, Mr Aleburu advised that one can make use of the google search engine to search for vendors online and everything about the company will be seen.)
- Make person see someting.
- E dey use am show sey wetin e talk must happen. — (jw__38259, He used it to show that what he has said will come to pass.)
- Wetin happun yesterday show say di movement ready to protest no mata what. — (bbc__4287, What happened yesterday proves that the movement is ready to protest no matter what.)
- Make person come somewhere.
- Ose, you go show for dat side next week? — (NSC_2021, Bro, will you show up at the other place next week? )
- Babe, person don dey call you, dey call you, when you go show naw? — (NSC_2021, Babe, we've been calling you repeatedly, when will you come?)
Related Forms
show face, show sense, show way
Synonyms
Translations
- English: reveal, express, come, visit