troway

Naija

Alternative forms

throway

Etymology

From English:"throw and away"

Pronunciation

  • tròwê

Play Play

Verb

  1. Make person carry someting make am move quickquick for air go anoder place.
    • Who troway dis pure water nylon for here?  — (Who discarded this empty sachet of water here?)
  2. Sey person carry someting con loss am.
    • I give Adamu money keep, e troway am.  — (I gave Adamu money to keep, he misplaced it.)
  3. Sey person use ginger do someting.
    • For di party eh, I dance troway give dem !  — (At the meeting, I danced vigorously and let them have it!)
  4. Sey person dey nack con comot sperm for body.
    • Man go fit dey troway sharp sharp as if e no dey okay medically.  —  (A man can ejaculate prematurely if he is not medically fine.)
  5. Make person para for anoder person.
    • E troway for office today. Obobs, every where just quiet.  — ( He got really angry today in the office. Man, everywhere became quiet.)
    • No vex sey I late. Na di bus wey I enter. Di conductor just troway give one agbero. We try hold am e no gree. Small ting e for open dat guy head o.  — (Please don't be angry that I came late. It was because of the bus I entered. The bus boy confronted a tout at the park. We tried to restrain him he refused. He almost broke the tout's head.)
  6. Make person shoot gun.
    • Police stop dem de go gree stop na im police troway for up. See as everybody dey move. No be small ting o.  — (They refused to stop when the police stopped them, then the police shot in the air. Everyone began to run. It was really serious.)
    • When chairmo enter, im boys just dey troway for up, make men know sey no be childs.  — (As soon as the boss came in, his boys shot into the air to make a statement.)

Translations

  • English: throw away, ejaculate, confront, shoot

Adverb

  • Make someting be like wetin no get level.
  • No go put body for wetin you no know o. Make you no go die troway.  — (Don't get involved with what you know nothing about. Just so that you don't die for nothing.)
  • Dat boy now don die troway. As e don talk sey na to tief na im good for am, see wetin don do am.  — (That boy has died for nothing. Since he decided that he has going to be thief, see what has happened to him.)

Translation

  • English: for nothing, uselessly