troway
Naija
Alternative forms
Etymology
From English:"throw and away"
Pronunciation
- tròwê
Verb
- Make person carry someting make am move quickquick for air go anoder place.
- Who troway dis pure water nylon for here? — (Who discarded this empty sachet of water here?)
- Sey person carry someting con loss am.
- I give Adamu money keep, e troway am. — (I gave Adamu money to keep, he misplaced it.)
- Sey person use ginger do someting.
- For di party eh, I dance troway give dem ! — (At the meeting, I danced vigorously and let them have it!)
- Sey person dey nack con comot sperm for body.
- Man go fit dey troway sharp sharp as if e no dey okay medically. — (A man can ejaculate prematurely if he is not medically fine.)
- Make person para for anoder person.
- E troway for office today. Obobs, every where just quiet. — ( He got really angry today in the office. Man, everywhere became quiet.)
- No vex sey I late. Na di bus wey I enter. Di conductor just troway give one agbero. We try hold am e no gree. Small ting e for open dat guy head o. — (Please don't be angry that I came late. It was because of the bus I entered. The bus boy confronted a tout at the park. We tried to restrain him he refused. He almost broke the tout's head.)
- Make person shoot gun.
- Police stop dem de go gree stop na im police troway for up. See as everybody dey move. No be small ting o. — (They refused to stop when the police stopped them, then the police shot in the air. Everyone began to run. It was really serious.)
- When chairmo enter, im boys just dey troway for up, make men know sey no be childs. — (As soon as the boss came in, his boys shot into the air to make a statement.)
Translations
- English: throw away, ejaculate, confront, shoot
Adverb
- Make someting be like wetin no get level.
- No go put body for wetin you no know o. Make you no go die troway. — (Don't get involved with what you know nothing about. Just so that you don't die for nothing.)
- Dat boy now don die troway. As e don talk sey na to tief na im good for am, see wetin don do am. — (That boy has died for nothing. Since he decided that he has going to be thief, see what has happened to him.)
Translation
- English: for nothing, uselessly