turn

Naija

Alternative Form

ton

Etymology

  • From: English turn

Pronunciation

tɔ̂n Play Play

Verb

  1. Make person from one side face anoder side.
    • Where you dey go? Turn di oder side?  — (Where are you going? Turn to the other side.)
    • Di road na straight road. Once you don pass Ore, na Lagos you dey face so. No turn.  — (It's a straight road. Once you go past Ore, you'll be moving straight to Lagos. Don't turn.)
  2. Make person change di way wey someting dey.
    Hold your steering well well. No dey turn your hand anyhow.  — (Hold the steering wheel firmly, don't turn it recklessly.)
    • As you don use the spanner hold di screw, turn am go as clock dey move make you tight am. If you want comot di screw turn am follow di oder side.  — (As the spanner fits the screw, turn it clockwise to tighten it. Turn it the other way if you want to loosen it.)
  3. Make person carry someting wey dey somewhere put for anoder place.
    • Turn di rice put for cooler, open am small make di smoke comot.  — (Put the rice in the cooler, the open it a little so that the vapour can escape.)
    • Abeg bring di drink come, make I turn small. My throat don dry.  — (Please pass the drink so I can pour a little into my cup. My throat is dry.)
  4. Make person use someting mix two tings make dey turn anoder ting.
    • If you don put di sugar and di butter, you go use turning garri take turn and well well. Use power take do am or you go tay for dere.  — (If you put the sugar and the butter in a bowl, you'll mix it very well with the spatula. Turn it vigorously, or you'll spend a long time doing it.)
    • If di rice don cook small, you go bring am come down, make small space for di centre con pour di stew put for dere. Put small water, den you go turn am small.  — (If the rice has parboiled, you'll take it down, make some space in the centre, then pour the stew there. Put a little and stir a little.)

Synonym

branch

Translation

  • English: turn, pour, mix, stir