eye
Naija
Etymology
From: English eye
Pronunciation
- áì
Noun
- Part of person body wey e dey take see someting.
- My eye dey pain me since morning o. — (NSC__2020, My eyes have been hurting since morning. )
- Look the police for eye. — (jw__2315, Looked at the police officer eye to eye.)
- Sand don enter im eye as e dey play with sand sand for outside. — (NSC__2020, He got some sand in his eye while playing with sand outside.)
- Di way wey person dey look something/somebody.
- Which kind eye we go take look the work wey dem give us? — (jw__45597, How do we view the work given to us?)
- Which eye I expect sey make e take look me? — (deuber__6567, How do I expect him to view me?)
Related forms
Translations
- English: eye, view
Verb
- Make person dey do face one kind one kind wey dey show sey e dey vex for person.
- For di meeting today ehn! Na so dem start to dey eye demsef. — (NSC_2020, During the meeting today, they were making faces at each other.)
- Make person dey get longer throat for someting.
- Saraki na number three oga for Nigeria goment and e be like say im dey eye to be Presido. — (bbc__87021, Saraki is the third highest officer in Nigeria government, but it seems he wants to contest for the post of the president.)
Related forms
Synonyms
Translations
- English: make faces, greedy
Idiom
Chop eye
- Make person deal with another person.
- E be like sey I go chop people eye. — (IBA_06_Linguistic-Fieldwork_DG__234, It seems I will deal with some people.)
Eye red
- Dey person get ginger to do something.
- Top-flight Spanish Club Barcelona eye dey red. — (bbc__85344, Top-flight Spanish Club Barcelona are eager.)
- Sey person dey vex.
- Bros, your eye dey red. Beans sef no dey. — (NSC_2022, Bros, I am broke. I don't even have beans.)
- No die for here o. Call your papa. Tell am sey atall atall make e arrange something.Tell am sey eye red. Clear am sey eye red die! — (NSC_2022,Don’t die here. Call your father. Tell him to send you something, no matter how small. Tell him that you are broke. Tell him that you are very broke.)