baby

(Redirected from Baby)

Naija

Etymology

From: English baby

Pronunciation 1

  • bébɪ̀

Play Play

Noun

  1. Pikin wey be sey e never grow to take care imsef.
    • Dem say you carry dis kind baby enter under sun.  — (BEN_01_Woman-Life-No-Easy_M__40, They said, Why did you bring this little baby out in the sun ?)
    • You talk sey grandma don dey behave like baby now.  — (IBA_09_Leon-And-Amos_DG__134, You said that grandma had been behaving like a child now.)
  2. Wetin person fit call anoder person wey be sey dem dey run tings.
    • Oh baby!  — (BEN_27_Boy-And-Girl_DG__96, Oh dearest.)
    • Guy, when your baby go show make we know am? Abi you want wait make una wedding reach?  — (Bro, when will your partner come around so that we can know her or do you want to wait till it's your wedding?)
  3. Wetin be sey person like well well.
    • Dis your new baby, e never tay wen e come out abi? Na chairmen dey buy Rolex o.  — (Your new baby has just been released, right? Only wealthy persons wear Rolex.)
  4. Wetin just be person own or wetin person just do or get.
    Di Nigerian singer talk sey im new baby go soon drop.  — (The Nigerian musician said his new project will soon be released.)

Synonyms

tata, pikin,

Antonyms

bros, sister, aunty

Translations

English: a little child, girlfriend doll

Pronunciation 2

  • bèbí

Play Play

Noun

  • Toy wey de dey buy for pikin wey resemble person.
  • See as she dey carry di baby wey you buy for am upandown.  — (NSC_2020, See how she is carrying the doll you bought for her everywhere.)
  • When we be small pikin if de buy toy motor for boy, de go buy baby for girl.  — (NSC_2020, When we were children, if they buy a toy car for a boy, they'll buy a doll for a girl?)

Related Forms

nwababy

Synonyms

tata, pikin, dollbaby, babe, sisi

Antonyms

mama

Translations

English: a little child, young lady doll