body

(Redirected from Body)

Naija

Alternative forms

bodi

Etymology

From: English body

Pronunciation

  • bɔ̀dí

Play Play

Noun

  1. Wetin dey cover human being or animal bone wey hair fit grow put.
    • E be like sey I no sleep well yesterday because since morning naim all my body dey pain me.  —  (It seems like I did not sleep well yesterday, because I’ve had body aches all over my body since morning.)
    • Na di next day I begin feel pain for all my body after I fall from okada.  —  (It as the next day I began to feel pains after I fell from the motorcycle.)
    • You go shock if you see mama Seyi now, she don get body, come fine.  —  (You’ll be surprised if you see Seyi’s mother now, she has put on some weight and is looking very good.)
    • Me, I no like men wey no get body.  —  (Personally, I don’t like slim men.)
  2. Di outside of someting wey someting.
    • No worry about wetin dem write for moto body, just enter.  —  (Don't pay a lot of attention to the inscriptions on the bus, just board it.)
    • No let oil pour for di body of di container as you dey turn di oil inside.  —  (Ensure you do not stain the oil container as you turn oil into it.)
  3. Group wey people form to follow deirsef do someting.
    • Na all di different women body join go government house for women day.  —  (All the different women organization went to the government house.)
    • Every State Government— go make am easy for voluntary organisation and oder body wey dey provide service wey State Government get power to provide as e be for section 177, 178, 182 and 183 for dis Act.  —  (childrights__525, __Every state government will make it easy for voluntary organisations and other organisations providing services under the authority of the State Government as stated in section 177, 178, 182 and 183 in this Act.)
  4. As person or animal take physically dey.
    • How body?  —  (How are you?)
    • How you want make person take sorry for you now? No be you carry your body go di place?  —  (How do you want someone to have pity on you now? Didn’t you willfully take yourself there?)


Related forms

pepperbody, scatterbody, deadbody, body odour

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: body, trunk, human physical frame, weight, the main issue

Idiom

Body no be firewood

Pronunciation

bɔ̀dɪ́ nó bɪ̀ faɪ̀àwûd


Play

Idiom

  1. De dey use am dey talk sey person need to dey rest.
    • Once once, dey try enter house before night reach, siddon, drink cold water. Body no be firewood o. If you move like dis, na your next of kin go chop all dis money o.  — (NSC_2021, Now and then, try to get home early, sit down, take a glass of cold water. You are not invulnerable. If you suddenly die, all you have acquired will be spent by your next of kin.)
  2. De dey use am dey talk sey person need make e dey nack
    • E no good make two of una just marry one person con dey stay Kano, di oder one go dey stay Lagos, look am wellwell o, body no be firewood.  — (NSC_2021, It isn't good to stay apart after marriage, one person in Kano, the other in Lagos, think about it carefully. You are human.)

Translations

  • English: you are only human