carry

(Redirected from Carry)

Naija

Alternative forms

Etymology

From: English carry

Pronunciation1

  • kárì

Play Play

Verb

  1. Make person take someting from where e dey.
    • Go carry food for kitchen.  — (Go and take your food from the kitchen.)
    • No forget your phone, carry am follow body.  — (Don't forget your phone, take it along.)
  2. Make person hold someting.
    • E go still release di oil wey e carry.  — (IBA_24_Mummy-Debbie_DG__59, It will still release the oil it contains.)
    • E no vex or carry wetin happen for mind.  — (jw__18975,He did not get angry or took what happened to heart.)
  3. Make person or someting get someting for body.
    • E don carry coro.  — (He has contracted coronavirus.)
    • We dey work with traditional rulers and oda ogbonge tori pipo wey go teach di pipo to stop am onto say na rat na im dey carry and spread di Lassa disease.  — (bbc__33635, We are working with traditional rulers and other prominent people that will sensitize the people on how Lassa disease is spread by rats.)
  4. Make woman get belle.
    • And dat belle I must carry am.  — (KAD_14_Stephen-Silas-Betting_DG__73, And that pregnancy, I must conceive it.)
  5. Make person win someting.
    • Wait! Who carry am? Di girls abi na di guys? Di girls!  — (deuber__2019, Wait! Who won? The girls or the boys? The girls!)
    • Last season, wetin you carry?  — (PRT_03_Football_DG__42, Last season, what did you win ?)
Synonyms
Antonyms
Translations
  • English: take, contract, conceive, carry, contain, win

Pronunciation2

kàrì

Play Play

Adverb

  • As person dey do someting anyhow as e like.
  • Una go dey insult people sey "eh de dey carry dey big, de dey old pass deir age we girls, you di boy now so, I want know wetin you don do now. you don build house? abi you don open store?  — (NSC_2021, You keep insulting people saying that they are not watching their weight, that we girls look older than our age, but you boys, what have you achieved? Have you built a house? Do you have a business? )
  • You can dey carry talk. Na until person use two by two take nack all your back na im you go sabi dey count word before you talk am.  — (NSC_2021, You talk very recklessly. It's only when you get beat with a big stick that you'll learn to talk with caution.)
Translation
  • English: recklessly, merely